'My employer point gun for my head' - Ghanaian lady wey suffer abuse for Iraq narrate ordeal

Ghanaians and other africans in the middle east suffer abuse
Wetin we call dis foto, Stephanie escape afta she suffer severe beating from her Iraqi domestic employer
    • Author, Komla Adom
    • Role, Senior Journalist, BBC Pidgin
    • Reporting from, Accra
  • Published
  • Read am in 7 mins

Di young Ghanaian lady inside one viral video wey suffer assault and abuse for di hands of her employers for Iraq don open up about wetin she go through.

Stephanie Nkrumah bin travel through some agent to Iraq to find beta job to take care of herself and her family.

But afta she arrive for 2025; she begin to work as house help for pipo, but dem take her through plenty wahala.

"Di agent collect money from my hand wey dem tok say if I arrive wey I begin to dey work, I go pay dem some of di money," Stephanie tok BBC Pidgin.

Her wahala begin from di moment she arrive for di Asian kontri - but she no fit do anytin about am until one year later.

Now dat she don escape wey she return home, she dey advocate for support for oda immigrants wey dey work as domestic staff for di middle east.

Ghana authorities say dem file formal protest to Iraq authorities
Wetin we call dis foto, "He even pull gun for my head and threaten me say if i no work, im go shoot and kill met"

"I suffer well well, I run away sake of I no wan die"

Like how many of dis agents and connection pipo dey treat immigrants, Stephanie suffer di same tin.

Bifor di trip, dem promise her say she go work for eight hours everyday wey she go rest, she also gatz pay back some of di money to di agents.

But tins neva go dat way.

"I neva work for eight hours; you go stay wit one pesin as family wey you go dey work until dem go sleep," di young lady wey dey traumatised tok BBC Pidgin.

She add say "we dey clean everywia, from one place to anoda, I neva find rest."

"For di beginning I work for two houses for two weeks, I neva get salary for dia, na di next place I begin to dey collect pay."

Stephanie bin dey try to comot di kontri since last year but she neva know how she go do am wey dem no go catch her.

But afta di latest incident wey bin go viral; she finally get di courage to run away.

Inside di viral assault video

ministry is offering her medical and psychological support
Wetin we call dis foto, Di Iraqi employer allegedly assault Stephanie many times sake of she say she dey sick

For di video wey Stephanie don confam say one Ghanaian man bin record, her employer dey assault her.

Di white man slap her many times, wey im drag her from di chair to di wall.

For di wall, im push her, wey im also use leg to stamp her.

E continue to kick her and slap her around di room many times.

Di attack happun for many minutes – as Stephanie just dey receive di beating.

She explain to BBC Pidgin wetin cause dat attack.

She confam say di white man for di video wey bin dey assault her na di boss of di agency wia she dey work.

"Dat day, I dey sick wey I tok di family wey I bin dey work for dia house say make dem carry me go hospital – but my boss for di house meet di man for di agency office wia I also dey work, wey dem speak dia language."

Stephanie say di agency boss carry her enta one room wey im begin to hit her.

"Di man slap me, wey im dey ask me why I say I dey sick; he say tok me say I dey hia to work, dat be how im continue to dey hit me."

"He even pull gun on me and threaten me say if i no work, im go shoot and kill me, he tok say im give my agent money wey mean say im don buy me; I no get right to fall sick or anytin like dat," Stephanie tok.

Di Ghanaian lady further explain say afta di beating dat day, dem lock her inside one room till di next day.

Afta dat day, Stephanie decide say she go plan to escape odawise she fit die.

How she escape from Iraq?

stephanie is happy she has a new lease of life
Wetin we call dis foto, Ghana authorities say dem dey consider to stop recruitment agencies from carrying citizens to di Middle East for domestic work

Stephanie say she bin dey chat wit her mama and papa every day, na so dem plan her escape.

Her papa wey dey Canada bin buy her ticket wey dem plan for her to run away from Iraq, but dat plan also no dey easy.

"Di day my wey I suppose travel, my madam bin tok me say we dey go some place – I begin to fear, but I bin call one taxi driver wey I plan wit am to carry me from wia me and my boss dey go, to di airport."

"Di driver gree to reduce di price from $150 for me, dat na how we arrange wey im carry me from di location to di airport."

Plenty tori dey say dis agents bin dey seize di passport and oda travel documents of dis immigrants wey dem dey carry enta dis middle east kontris to do domestic work.

Di reason na say dem no want make dem escape or run away.

But for Stephanie, wetin help her to keep her passport na di way she bin dey work across cities.

For some of di places wia she bin dey travel to work, she gatz show her passport and documents for checkpoint.

"Sake of I dey work for many houses, sometimes di madam go carry me go anoda house out of di town wey she go leave me for dia."

Stephanie explain to BBC Pidgin say "If I for return alone, I gatz use my passport and oda permit to pass di border wia dey dia. Dat be how I get my passport to plan di escape."

Ghana say dem file protest to Iraqi authorities ova di mata

Stephanie is under medical observation and getting psychological support

Ghana Foreign Affairs minister Samuel Okidzeto Ablakwa say di kontri don file protest.

"Di govment don formally protest to Iraq authorities wey we dey demand appropriate action."

"We dey pursue justice for Stephanie; we want make dem find di man, we gatz trace di address and make sure say Iraqi authorities deal wit am."

Di minister say dis situation wia Ghanaian citizens go dey suffer abuse and assault for di hands of foreigners gatz stop.

Im also tok say di govment dey work to deal wit dis agencies wey dey recruit young pipo to go and suffer for foreign kontris.

"Govment dey strongly consider to stop di recruitment of domestic workers to Iraq sake of dis no be di only case," oga Okudzeto Ablakwa tok.

Di minister tok say Stephanie dey receive medical care wey dem also offer her psychologist wey dey take care of her.

Di minister donate GHC50K for her initial support for her to start small business, im also promise her scholarship to help her go back to school.

'Oda Africans wey dey work as domestic staff for Middle East dey suffer abuse'

Stephanie be lucky say she manage to escape – but no be every pesin wey dey fit succeed.

She say as much as she want justice, she want make oda Africans wey dey suffer in silence to speak up.

"I want justice; wetin I go through, oda pipo dey go through worse tins. I even know one pesin wey die.; I dey dia when she burn wey she die three days later," Stephanie remember di sad story.

She add say "I neva dey sure say her family serf know say she die, dis be di time we gatz speak up for ourserf."

"I dey lucky say my own no reach dat stage but dis na di time all di pipo wey dey do domestic work out dia go get support."

"We tink say we dey go find work to support our family, but when we go tins no dey di way di agents dey promise us. We need help for our brothers and sisters wey still dey suffer dis kind tin out dia."

Stephanie dey happy say she survive wey she get anoda chance to live, she dey grateful to di kontris Foreign ministry wey dey pursue justice for her.