Katsina State govment suspend Emir of Daura sake of alleged sexual assault

Wia dis foto come from, Katsina State govment/X
Katsina State govment don suspend all official engagements and travels of di Emir of Daura, Umar Farouk sake of investigation into di alleged sexual assault of one oyibo tourist.
Di state govment say dem go fully implement di findings of di committee and recommendations afta di commitee chook eye inside di mata wey involve dei monarch wey don go viral.
Di State govment set up committee to investigate di allegation of sexual assault.
For statement wey govment release on Tuesday for dia X handle, dem say Govnor Dikko Umaru Radda dey concerned about di allegation wey don spread for social media.
Dis dey come afta one video showface for Instagram on Saturday, 21 November 2026, wey one tourist bin dey allegedly accuse di emir of sexual assault inside im palace.
Tori be say dem remove di video from di platform 48 hours afta dem post am.
For one post wey dem share through Instagram account bequinqa, di tourist tok say: "I don travel all ova Nigeria: Oron, Calabar, Ibadan, Uyo, Benin City, Lagos, Abeokuta, Ibadan, Osogbo, Ilorin, Abuja, Jos, Bauchi, Dutse, Kano, Zaura, Katsina, Daura. I don explore di natural beauty, historical places, cultural events."
She later express shock over wetin happen, and caption di video wey she record with her Meta glasses as "Assaulted by Emir of Daura, Nigeria".
Katsina State govment say dem take di allegation seriously, and Govnor Radda don give order make dem set up committee to investigate di mata and advise govment on wetin to do next.
Dis allegation still dey cause tok-tok for Nigeria as di deleted video still dey fly upandan for di kontri.
Umar Farouk dey 95 years old. E becom Emir of Daura on 28 February 2007.
E take ova from Sarkin Muhammadu Bashar dan Umaru afta e die. E don rule Daura for 19 years.
We go dey update dis tori

















