NDC senatorial candidate Ovie Omo-Agege escape campaign attack wey allegedly kpai four pipo

Wia dis foto come from, Ovoe Omo-Agege Facebook
Di Nigeria Democratic Congress (NDC) don strongly condemn di kasala and attacks wey dey happun to members of di political party.
Dis dey come afta viral video wey dey fly upandan online show pipo wey get different kain injury on Wednesday for Uduere Community, Ughelli North Local Govment Area, Delta State.
For statement wey di Nigeria Democratic Congress release on Monday night, di party clealy condem di act wey happun to di campaign train of dia senatorial candidate, Ovie Omo-Agege.
For statement wey di National Publicity Secretary, Osa Director sign, e say jaguda pipo attack di campaign train of di NDC senatorial candidate for Delta Central and former Deputy Senate President (DSP) Ovie Omo-Agege.
E allege say di party suspect say di jaguda pipo na agents of di ruling party, di All Progressives Congress (APC).
"Sadly, as at press time, four pipo dey feared dead, including a close aide of DSP Omo-Agege, while several odas sustain different degrees of injuries. Indeed, Omo-Agege narrowly escape assassination."
Di National Publicity Secretary claim say dis na attack against di NDC for di umpteenth time for Delta State.
"Na clear and calculated, and cowardly attempt to silence opposition voices and scare our members and supporters away from di democratic process."
Di party dey call on di Nigeria Police and all relevant security agencies to immediately investigate dis attack and make dem bring di suspects and di pipo wey dey sponsor dem to face di law.
"Election no be war. No life suppose loss for di contest for power."
Police declare curfew for part of Delta State
Meanwhile di Delta State Police don declare 6.00pm to 6.00 am curfew for Ughelli North Local govment area.
Dis dey come afta di reported violence during di campaign rally of di NDC senatorial candidate, Senator ovie Omo-Agege for Uduere Community, Ughelli North Local Government Area.
According to statement wey dey Delta State Police Command release dem say di violence allegedly kpai pipo.
"Di Delta State Govment don impose curfew for Ughelli North Local Govment Area, from 6:00 p.m. to 6:00 a.m. daily until further notice. Di Command dey start investigations to ascertain di circumstances surrounding di incident and identify di pipo wey dey responsible."
Di Police Command dey tell residents to strictly wit di curfew wey dey restrict movement between 6.00pm to 6.00 am until further notice.
'I bin dey lucky my DSS detail na professional' - Omo Agege
Di Former Deputy Senate President Ovie Omo-Agege allege say di gunmen wey attack im campaign team for Delta State, kpai four pipo and dem bin dey shout im name and declare say na him dem want.
Omo-Agege, dey conytest for di Delta Central Senatorial District on di platform of di Nigeria Democratic Congress (NDC) for di 2027 general elections.
Im tok say im escape di attack sake of di intervention of im Department of State Services (DSS) escorts.
Im tok on Monday wen im bin showface as guest ontop Channels Television Politics Today.
Di former deputy senate president claim say im bin hear as di attackers dey shout say dem wan kpai am as dem begin shoot for di campaign venue.
"Right dia for di venue, wen dem bin dey shoot, we dey hear dem say, 'na Omo-Agege we want to kpai. We must kpai Omo-Agege.'
"But I bin dey lucky becos my DSS details bin dey veri professional. In fact, afta God, di only reason I dey alive today na becos of di DSS operatives wey bin dey wit me," Im tok.
Omo-Agege describe di incident as attack wey di jaguda pipo plan, im allege say di kasala bin don dey gada force.
Police dey investigate di mata to chook eye well-well as ctach di pipo wey cause dis kasala.
Anoda politician wey from Delta State, Festus Keyamo wey be minister of Aviation and Aerospace Development condemn di violence strongest and di killing of pipo.
E say make law enforcement agencies fish out di pipo wey cause dis killings, both for Asaba and Ughelli, and bring dem to book.
"Since 1999, Delta State dey relatively peaceful politically. Our disagreements neva lead to violence and killings." Keyamo tok for satatement for im social media.
Recently Nigeria President Bola Tinubu condemn cut warning sake of attacks wey dey happun for politial rallies but even wit di warning dis violence still dey happun.




















