Inec announce nationwide mock accreditation exercise ahead of 2027 general election

One Nigeria electoral officer hold BVAS dey try capture one man
Wetin we call dis foto, One Independent National Electoral Commission (INEC) official dey use Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) to check di details of a voter for one polling station for Maiduguri on February 25, 2023,
Published
Read am in 1 mins

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don announce Saturday, 28 November as di date dem set aside for nationwide Mock Accreditation ahead of di 2027 general election wey go hold on 16 January.

Di kontri electoral body for statement tok say dem go also test di Result Upload Exercise using the Bimodal Voter Accreditation System (BVAS).

Di exercise go hold from 8:30 to 2:30pm.

According to Inec, di exercise na to test BVAS functionality, assess accreditation procedures and identify possible technical issues ahead of di 2027 General Elections.

Di commission add say e go take place for two two Polling Units for each of di 8,838 Registration Areas nationwide.