US announce new tariff proposals on 14 countries

Wia dis foto come from, Getty Images
Di United States don announce new tariffs on some of dia biggest trade partners wey include China and di European Union.
Di new taxes wey dem charge on imports to America go hit many of di kontri biggest trading partners, wey include China, di European Union plus 12 oda jurisdictions.
Di proposals for new tariffs dey come afta di White House launch one investigation for March into di trade practices of oda countries.
China dey face di highest rate of "up to 40%", followed by Vietnam wey reach up to 35% and odas dey face either 20% or 25%.
Di new tariffs na ansa to wetin di US call "structural excess industrial capacity".
Di tariffs dey imposed afta Section 301 investigation to structural excess capacity and productions for manufacturin sectors.
Di economies wey dey inside dis investigations na: China, di European Union, Singapore, Switzerland, Indonesia, Malaysia, Cambodia, Thailand, Korea, Vietnam, Taiwan, Bangladesh, Japan, and India.
Different tariffs go apply to different kontris and products.
China dey face di highest rate of "up to 40%", followed by Vietnam wey dey face up to 35%, and odas go face either 20% or 25%.
But, even wit all ones, some of dem go reduce bicos of caps on tariffs wey President Trump dongree from bifor.
Dis no go be di first time wey Donald Trump dey run sometin like dis.
For April last year, Donald Trump reveal sweeping tariffs for global trading partners wit im presidentialemergency powers.
Tori be say many of dis tariffs, Supreme Court quick block am.
So, dis new import taxes wey dem announce on Wendnesday na new effort to put back Trump tariffs.
But im administration dey take anoda approach which mean say e go ikely tanda wen legal wahala wan come push. Dis na according to trade sabi pesin, Jayant Menon from di ISEAS-Yusof Ishak Institute.
Meno says, dis new rates go apply to fewer jurisdiction dey lower and more uniform dan di ones of last year.
Dem also dey based on months long investifation wey di White House commission to di labour and trade practices wey dis territories dey use and hoe dem fit affect di US.


















