Ogbonge actor Pete Edochie die at di age of 79

Pete Edochie
Published
Read am in 1 mins

Ogbonge actor Pete Edochie don die.

Im family announce for statement say di actor die at di age of 79 years afta a battle wit prostate cancer on Wednesday by 12:30am for Enugu State Nigeria.

Edochie na retired broadcaster and ogbonge actor wey dey popular for feems wey make impact including di classic adaptation of Chinua Achebe 'Things Fall Apart'.

Life and Times of Pete Edochie

Dem born Pete Edochie on March 7, 1947, for Zaria, Kaduna State, Edochie although e come from Akamnato, Ifite Nteje, for Anambra State.

E attend St Patrick and St James Primary Schools for Zaria before e move to St John's College, Kaduna. E bin also study journalism and television for di School of Journalism and Television for England.

Before e become ogbonge name for Nigerian film industry, Edochie bin build a career in broadcasting.

E bin join di Eastern Nigerian Broadcasting Corporation for 1967 and rise to become Director of Programmes for di Anambra Broadcasting Service, wia e also serve as Deputy Managing Director and occasionally act as Managing Director.

Edochie breakthrough as actor come from im role as Okonkwo for di feem wey Nigerian Television Authority, NTA, bin adapt from Chinua Achebe ogbonge novel, Things Fall Apart.

Im performance as di Igbo warrior give am accolade and establish am as one of Nigeria leading television actors.

Some of im oda feem wey e act inside include Rituals, Billionaire's Club and Genevieve Nnaji 2018 film Lionheart, wia e act as Chief Ernest Obiagu.