Nollywood icon die: Life and times of ogbonge Nigerian actor Pete Edochie

Wia dis foto come from, Pete Edochie/IG
Ogbonge Nollywood actor Pete Edochie na one of di most respected actor wey Nigeria and Africa don produce.
Pipo sabi am well-well sake of im deep voice, im strong character, wisdom, di way e take dey use African proverbs, and di correct way e take dey deliver im roles for feems wey mostly be di role of traditional ruler, father, king, chief and community leader.
Edochie no be just entertainer, e don bicom symbol of African culture, tradition, authority and storytelling.
One interesting tin about im life be say bifor e become big name for acting, e don already make name for broadcasting.

Wia dis foto come from, Pete Edochie/IG

Wia dis foto come from, Pete Edochie/IG
Dem born Pete Edochie wey im real name na Peter Uwadiegwu Ogugua Edochie on 7 March 1947.
E hail from Anambra State, southeast Nigeria. Di veteran actor also na traditional title holder, e be di IBOBO 1 Umueri Kingdom.
Bifor e bicom di respected and famous Nollywood actor wey many pipo bin come to know now, Edochie bin start im career for di broadcast industry.
For 1967, Edochie join di Eastern Nigerian Broadcasting Corporation (ENBC) as junior programmes assistant. E later rise for di profession to di position of senior broadcasting executive.
For 1980, e travel go UK to get more professional training from di British Broadcasting Corporation (BBC).
E also work wit Anambra Broadcasting Service, wia e later bicom di Director of Programmes and e hold oda important managerial positions.
On how im acting journey take start, Edochie begin act many years ago for di 1960s, bifor Nollywood bicom di name wey evribody know am as today.
1962: Wen e be 15-years-old, e perform for stage production of Shakespeare play, di Merchant of Venice.
1985: E act as di central character, wey be Okonkwo, for television adaptation of Chinua Achebe novel, Things Fall Apart. Na dis movie bring am to limelight.
1987: Di television production bicom widely known wen Nigeria largest television network, NTA start to dey air am.
1992 onwards: Nollywood begin take shape following di success of Living in Bondage. By dis time, Pete Edochie don already establish imsef as a television actor.
For one interview wey e give for 2023, e explain say iim acting career don kick off long bifor Nollywood even exist as an industry.
Na why e dey make sense wen people say Edochie na one of di pioneers of Nigerian screen acting.
Di feem movie wey really put di legendary actor for international spotlight na 'Things Fall Apart', one ogbonge Nigerian author book Chinua Achebe wey dem adapt to feem. For di movie, e bin play di character of Okonkwo.
Okonkwo na strong, proud and traditional Igbo man wey believe say man must dey strong and must not show any sign of weakness.
Edochie carry dat character win pipo heart through im powerful acting plus di ogbonge way e take deliver di role
Through that role, e show say e sabi act character wey carry strength and authority, pride and masculinity, traditional African values, fear of failure and weakness, among odas.
Dat role change di trajectory of Edochie acting career, as pipo begin associate am wit di the image of a traditional African father, King and community leader.

Wia dis foto come from, Pete Edochie/IG
Afta Things Fall Apart, di legendary actor don go on to feature and produce more ogbonge projects wey include Igodo, Rituals, Billionaires and di Lionheart, wey e play di character of Chief Ernest Obiagu, among plenty odas.
Bifor im death, im bin dey di set as one of di cast for one feem wey dem go release for cinema for December dis year.
On im personality, Chief IBOBO 1 Umueri Kingdom get a larger dan life personality. E believe say Africans suppose get pride for dia culture and heritage, and e dey interpret im believe for im movie roles.
E dey encourage pipo to value African dressing, language, traditional customs and indigenous ways of life.
Na why plenty times, wen e dey for any movie, e dey play role of father, king or elder and im words on set det carry big weight.
Edochie don express strong views about marriage, loyalty and family responsibility.
E believe say marriage no be sometin wey pesin suppose enta anyhow without understanding di responsibility wey come wit am.

Wia dis foto come from, Pete Edochie/IG
One tin wey distinguish Edochie from im peers and one tin wey e dey very famous for na im quotes.
All im words dey always carry great quotes wey dey resonate wit circumstances, situations or events at di time.
Some na traditional African proverbs, especially Igbo, wey e make popular through performance for screen, di ones wey e tok during interviews and public appearances.
Dis wise sayings bin cement im reputation as di "King of Proverbs", or di wise elder of Nigerian cinema.
Some of im famous proverbs include:
- Pesin wey dey sell eggs no suppose start fight for market.
- Beware of di naked man wey offer you clothes.
- Di little opportunity dem give monkey to wear clothes no guarantee am to join di dining table.
- If man wan grow long tooth, e suppose get lip wey go cover am.
- If you sell your papa land buy trumpet, wia you wan stand blow am?
- Even if he-goat dey frown face, e no go stop pipo from pricing am for market.
- Na foolishness we all get as human beings, but some pipo believe say na dia birthright to improve dia own.
- If fool sabi keep quiet for public, pipo go tak am for wise pesin.
- Wolf wey dey top hill no dey hungry reach di one wey dey struggle to climb go top.




















