Burkina Faso, Uganda, Niger and oda kontris on America 'do not travel list'

Wia dis foto come from, Anna Moneymaker/Getty Images
United States don identify 23 kontris across Africa, Asia and Europe wey dem consider too dangerous for American citizens to visit.
US Department of State for di latest travel advisory dem release on Wednesday, 15 July, place di 23 kontris on "Level 4 - Do Not Travel". Dem warn dia citizens not to visit di kontris for "any reason".
Ten of di kontris for di list na from di African region - dem include Burkina Faso, Uganda, Democratic Republic of Congo, Mali, Niger, Sudan, among odas.
"We issue Travel Advisories wit Levels 1 - 4. Level 4 mean DO NOT TRAVEL. We assign Level 4 based on local conditions and/or our limited ability to help Americans dia," di advisory tok as e label di kontris as "dangerous places".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Full list of 'do not travel' kontris
Afghanistan
Belarus
Burkina Faso
Burma
Central African Republic (CAR)
Chad
Democratic Republic of the Congo (DRC)
Haiti
Iran
Iraq
Lebanon
Libya
Mali
Niger
North Korea
Russia
Somalia
South Sudan
Sudan
Syria
Uganda
Ukraine
Yemen
Why US put di kontris for Level 4 travel advisory
Most of di countries don dey di list for years sake of di ongoing armed conflict, terrorism, violent crime, kidnapping, civil unrest or weak govment control for some parts of dia territories.
Uganda - na di newest addition afta di U.S. upgrade di kontri travel advisory to Level 4 sake of Ebola outbreak plus concerns ova crime, terrorism and civil unrest.
Although, di East African kontri don dey report progress for dia response to di virus, as govment officials say dem go discharge di last Ebola patient on Thursday.
Di Department of States for statement say violent crime na real danger for Uganda, and e include armed robbery, home invasion, and sexual assault.
Dem add say risk of terrorist violence, wey include terrorist attacks dey for di East African kontri and protests dey often happun wit little to no warning.
Di Donald Trump administration also implement one new restriction under Title 49 of di U.S. Code wey ban U.S. citizens and nationals wey don dey DRC within a 21-day period from entering di United States through commercial aviation.
DR Congo – Di Department of Homeland Security tok say sake of di Ebola outbreak for di West Africa kontri, dem don implement new restrictions under Title 49 of di U.S. Code wey stop U.S. citizens and nationals who have been in the DRC within a 21-day period from entering the United States via commercial aviation. For statement, di US govment say dem no go allow travelers wey don dey DR Congo within 21 days of to board flights wey dey go U.S. destinations. "Make all U.S. citizens and U.S. nationals wey don visit DRC plan to remain outside di West African kontri for 21 days bifor de menta di United States," di statement tok.
Na for April, di US put Burkina Faso on di no travel list sake of crime, kidnapping, terrorism and health.
Mali - Na for June, US put Mali on di no travel list and na sake of crime, kidnapping, health, terrorism and health. Di same apply for Niger. Di three Alliance of Sahel states dey di list.
Wetin Level 4 advisory mean
US State Department travel advisory system dey range from Level 1 ("Exercise Normal Precautions") to Level 4 ("Do Not Travel").
Level 4 na di higherst advisory level sake of life-threatening risk. Dem dey reserve am for places wia di govment believe say di security or health risks dey very serious.
Di U.S. government say dem fit get very limited or no ability to help, including during emergency wen kasala burst for these countries.










