'We make difficult decision’ - Uber tok why dem shutdown operations for Nigeria

Wia dis foto come from, Klaudia Radecka/NurPhoto via Getty Images
Ride hailing company wey dey popular Uber don announce say dem dey comot from Nigeria afta spending close to 12 years.
Di company say na “very difficult decision” for dem to comot from Nigeria but dem gatz do am sake of dia “business priorities”.
Plenti tori bin dey spread for social media say Uber dey comot Nigeria - na so di BBC reach out to di company and dia partners wey come confam dia decision.
Dem confam say truly Uber dey shutdown for Nigeria and dia users no got fit access dem once dey comot.
"Di decision dey specific to Nigeria and Uganda and no affect Uber operations for oda African markets."
According to dia statement, dem say dem go stop operation from 2 September, 2026.
"Uber today announce dia decision to discontinue operations for Nigeria and Uganda from 2 September 2026, sake of review of dia evolving business priorities and investment focus across Africa."
Some Uber customers for Nigeria bin receive emails wey tell dem about di shutdown.
Di company say dia help centre go remain open until 24 September to deal wit customers kwesion and oda issues related to di shutdown closure.
"We remain committed to Sub-Saharan Africa, wia we kontinue to see strong growth and opportunity."
"We dey focus on our investments on markets wia we believe we fit add di most value for drivers by providing earning opportunities at scale and enabling riders to go anywia seamlessly."
Uber don dey operate for Nigeria since 2014, as dem expand dia services beyond car journeys ova di years.
For Lagos, dem launch boat service for 2019, say di service dey designed to help reduce traffic congestion for di city.
Di Nigerian market become challenging for ride-hailing companies as drivers don stage protests bifor in recent years ova rising operating costs, low fares and working conditions.
Driver representatives don call for higher fares, lower commission charges and better protections.
Why Uber dey shutdown for Nigeria
Uber make am clear say dis decision dey limited mainly to Nigeria and Uganda markets and 'e no go impact our operations across di rest of di continent.'
Dem tok why dem dey comot for Nigeria, afta spending about 12 years for di kontri.
Uber say na sake of business priorities and di kain investment wey dem wan focus on.
"Afta we tink am well-well, we make di difficult decision to discontinue operations for Nigeria and Uganda as part of our business priorities and investment focus wey dey change across di continent."
Dem say dem dey focuse on markets wia dem dey get di most value for dia drivers so dem go fit make beta money.
"We dey focus our investments for markets wia we beliv say we fit add di most value for drivers by providing opportunities wey dem fit use make beta money and riders fit go anywia dem wan go witout problem."
Dem say dii decision of Uber to end operations for Nigeria no dey related to di recent FAAN directive wey concern e-hailing operations for Nigerian airports.
Wetin go happun to Uber drivers and customers
Uber get several employees for Nigeria also get partners wey dem dey do business wit.
We ask dem how dis shutdown go affect dem and di drivers wey dey rely on Uber for job opportunities.
"We dey continue to do tok tok directly and responsibly wit affected employees, drivers and riders about wetin e mean for dem."
Although some users don alreadi receive di mail but Uber say dem go kontinue to support employees wey dey affected.
"We dey committed to support employees wey dey affected through di transition and we go communicate directly wit dem regarding di arrangement wey apply to dem."










