Who be di 28 governorship candidates of opposition ADC for 2027 elections

Wia dis foto come from, ADC/X
Former Labour Party govnorship candidate for di 2023 election, Gbadebo Rhodes Vivour and former Attorney General of Nigeria, Abubakar Malami names dey for di list of govnorship candidates wey di African Democratic Congress (ADC) release.
Di opposition party for Nigeria publish di names of di pipo wey dey contest for govnorship position and dia deputy for di 2027 general elections for 28 states.
Dis one mean
Anoda popular name for dis list na Great Ogboru of Delta State wey don dey contest to be govnor since year 2000. Im bin constest against former Delta State govnor James Ibori.
Since year 2000, Ogboru don join different political parties back to backl but im neva emerge as winner.
For post wey di National Publicity Secretary of di political party, Mallam Bolaji Abdullahi sign for dia official page, dem tok say dem bring out dis list " to offer Nigerians credible leadership and real alternative."
Di Action Democratic Congress dey face serious internal gbege sake of di kasala wey dey happun for some states wey get factions.
Even though dem bin dey try to solve di mata, e drag sotay di two factions land for court and court still dey do back and front for di mata.
End of Di one wey oda users dey read well well
Full list of ADC govnorship candidates and dia states
Abia State
Kalu Kalu Agu
Alozie Ogadinma Darlington
Adamawa State
Modibbo Hamman Tukur Ribadu
Aguwa Kevin Iliya
Akwa Ibom State
Akpanudoedehe John James
Nsien Mkpombik Tommy
Bauchi State
Sen. Haliru Dauda Jika
Sama'lia Mohammed Kabir
Benue State
Rt.Hon Herman Iorwase Hembe
Abba John Abba
Borno State
Babagana Buhari
Mamman Dauda
Cross River State
Nkoyo Toyo
Okwoche Andrew Adagbor
Delta State
Great Ogboru
Afiari Gloria
Ebonyi State
Ukpai Mbah Ude
Onwe Daniel Ede
Enugu State
Ochi Oboozeze Chukwuma
Eze Anrze Christopher
Gombe State
Bala Bello
Bala Sani Sisa
Jigawa State
Sabo Mohammed Nakudu
Musa Yau Balarabe
Kaduna State
Isa Mohammed Asiru
Kantiok Rmiya Ishaku
Kano State
Ibrahim Ali Amin
Shehu Abdulkadri Bari
Katsina State
Sen, Ahmad Babba Kaita
Aminu Yar Adua Ahmed
Kebbi State
Abubakar Malami
Zagi Musa Mohammed
Kwara State
Zakari Mohammed
Olawuyi Julius Olayide
Lagos State
Gbadebo Rhodes Vivour
Gbadamosi Babatunde Olalere
Nasarawa State
Nuhu Angbazo
Ahmed Yusuf
Niger State
DR. Mohammed Kpautagi
Musa Mamman
Ogun State
Biodun Collins Ogundipe
Muraina Oluwaranti Oluyemi
Oyo State
Taofeek Adegboyega Adegoke
Wahab Adeniyi
Plateau State
Brig.Gen John Sunday Sura
Pwajok-Kele Chundung Bitrus
Rivers State
Gabriel Pidomson
Okumgba David Amapakaye
Sokoto State
Manir Mohammad MOHAMMAD Daniya
Isah Bello Ambarura
Taraba State
Abubakar Umar Tutare
Kwetishe Haruna Kwenyan
Yobe State
Kassim G. Gaidam
Kori Lawan Mohammed
Zamfara State
Shinkafi Bilyaminun Yusuf
Muhammad Abdulmuddalib Auwal
Why 28 states inside of 36 and di FCT?
Di African Democratic Congress publish di names and deputy govnorship candidates sake of say na di ones wey go run for di 2027 elections.
Oda states don do dia own elections and doz states na di states wey dey do off-cycle election for Nigeria.
Di off-cycle election states na Osun State wey just do dia own last month, 15 August wey Ademola Adeleke of Accord Party win and ADC candidate na Najeem Salaam.
Bayelsa , Anambra, Imo, Ondo, Edo, Ekiti and Kogi na oda states wey dey do off- cycle elections.













