'Within one year we go control insurgency and insecurity for Nigeria' - Atiku Abubakar

Former Vice President of Nigeria Atiku Abubakar don assure Nigerians say im go control di insurgency and insecurity problem for Nigeria within one year if e enta office.
Di presidential candidate of di African Democratic Congress (ADC) give dis assurance for exclusive interview wit di BBC.
Since di official window for presidential campaign open, Atiku Abubakar dey grant interviews wia e dey tok about im plans for Nigeria if im becom president.
Atiku wey don contest plenti times to becom president of Nigeria but neva dey successful tok say Nigeria need to invest for police and di armed forces.
E also tok how e go take control one of di biggest problems for Nigeria and di West Africa regional bloc.
According to di veteran politician Nigeria get 200 million pipo, and yet di number of police officers and men dey small.
"We dey ova 200 million pipo, and yet we get less dan 200,000 policemen.
Egypt, wey dey about 80 million, get one million policemen on dia streets, and na why peace dey for dia. Dis kontri need to invest in police, in di armed forces, to make sure say we guarantee peace for evribody."
Di businessman wey from northern Nigeria say e no go waste time bifor Nigeria start to see positive changes for security mata wen e becom president.
"And believe me, within one year we fit control dis insurgency and insecurity wey dey evriwia.
E explain say on eof di reasons why di problem of insecurity dey increase na becos of di relationship between West African kontris wey no too good and bandits dey enta Nigeria from dos kontris."
Atiku also provide more solutions to end di relationship problem wey Nigeria get wit oda West African kontris.
"First of all, I go make sure say dey Economic Community of West African States (Ecowas) come back togeda into one, no be di breakaway wey we get now.
And den secondly, we go get model. We bin don use Ecomonic of West African States Group Monitoring (Ecomog) biforto, restore peace and democracy for Ivory Coast, Sierra Leone, Liberia. And if we get a standing force like dat to fight insurgency and insecurity within di sub-region, I beliv say e go bring about peace and stability and prosperity for di region. I tink say Nigeria dey wrong to allow dos
kontris to comot."
Di former presidential candidate of di Peoples Democratic Party for di 2023 election also tok about di Nigerian borders wey dey closed for northern Nigeria meanwhile oda borders for southern Nigeria dey open.
"We no fit trade wit Niger. We no fit trade wit Chad. We no fit trade wit Cameroon. We no fit trade wit di same. But dem fit trade wit di Republic."
2027 opposition and wen e dey contest evritime
On weda di opposition go come togeda as one for di 2027 presidential election Atiku say dem still dey do tok-tok about am.
"We still dey tok to oursefs, na issue of strategy. No worry. We go come togeda".
About why e dey contest evritime for presidency even though e no neva win, e tok say to contest na im constitutional right and if im lose dis election e no go contest again.
However Atiku add say im dey strong, agile and healthy to constest di presidential election. Im also alleged say if na about age, e young pass di current president of Nigeria and im go fit prove am say President Bola Tinubu old pass di age wey im tok say im be.
About fuel subsidy Atiku say im don do tok-tok wit economists and experts wey tok say di subsidy removal, wetin don come out from subsidy removal neva benefit di ordinary Nigerian.
"E don further throw more Nigerians into poverty, a bracket or net of di economy. "










