Niger army see plenty weapons for Base 101 wia mutiny happun, wetin go happun to di sojas afta di coup attempt wey fail

Niger military

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Niger army say dem don find large amount of weapons and military equipment for Base 101 for Niamey afta di failed mutiny wey happun for different parts of di kontri.

Dem say di weapons wey dem uncova include heavy weapons, rockets, explosives and large quantities of ammunition.

For Saturday 29 August, 2026, Niger witness military attack for some strategic locations afta sojas fight to restore order.

Later, Niger say dem don regain control of key military airbase for di capital, Niamey, afta di revolutionary soldiers launch attack.

Niger state-run television bin describe di attacks for Niamey, as attempted coup, but say di situation dey under control.

Di fighting, wey happun for Saturday, 29 August na di latest challenge to military ruler Abdourahamane Tiani, wey im govment for long time now dey battle serious jihadist insurgency.

According to di state broadcaster Tele Sahel, dem say di ammunitions wey di Niger Army find and di kain amount wey dem find na serious threat to di kontri capital and oda military formations.

Base 101 na strategic military air base formation for Niger capital, and e no far from di airport too.

Which kain weapons Niger army find for di capital

According to di state broadcaster, dem say di inventory wey dem conduct afta di mutiny show say na " arsenal of war of disproportionate quantity",

Part of di weapons and ammunitions wey di army recova from di base include 34 armed Toyota pickup trucks, two light armoured vehicles and several dozen motorcycles.

Di state-broadcaster add say di weapons include 382 AK-47 rifles, 36 RPG-7 launchers, 30 BKM machine guns, six 12.7mm machine guns, four 14.5mm cannons and four Dragunov sniper rifles.

Dem also list 82mm mortar, 17 automatic pistols, ammunition crates, dozens of magazines and communications equipment as part of wetin dem recova.

Wat next for di sojas afta di Nigeri coup attempt

Afta di failed coup attempt, Niger Ministry of Defence explain say some group of soldiers wey break military rules bin detain some of dia colleagues for Base 101.

Di sojas also open fire for several sensitive locations for di capital, di ministry tok.

Anoda tori say di mutineers bin try to detain military personnel for di base and dem fire gunshots on several sensitive locations for Niamey.

Heavy gunshots and explosions blast across parts of Niger capital, Niamey dat early mormor on Saturday, according to eyewitnesses.

Dem say serious fight happun near Diori Hamani International Airport, di military Base 101 and di presidential palace.

Some sojas run comot for dia location, and some dey miss from dia position afta di mutiny attempt.

Niger army don come out to say make officers and soldiers wey go missing from dia positions during di mutiny to return to service.

For one communiqué wey dem read for di state broadcaster Télé Sahel, di army say make military personnel wey participate for di mutiny and dey in di run report to di Gendarmerie School for Niamey or di brigades.

"Dose wey wish to resume dia services suppose to present demsef individually and possibly wit dia weapons, ammunition and any oda military equipment wey dey dia disposal," di statement say.

Dem say dis go help return proper nolmacy to di kontri as dem go welcome dose wey "in spirit of responsibility and loyalty to di nation and choose to return to di ranks".

Now, di Niger authorities don ban civilians make dem no wear military uniforms anyhow again.

Dem say na sake of di current securiti situation for di state and anyone wey dem gba go face serious legal action.