Senator Sharafadeen Alli campaign organisation react to viral video of govnorship candidate wit students wey dey make Nigerians tok

Senator Sharafadeen Alli carrying a student on his lap

Wia dis foto come from, @lindaikejiblogofficial/Instagram

Published
Read am in 3 mins

Di campaign organisation of di All Progressives Congress (APC) govnorship candidate for Oyo State, Senator Sharafadeen Alli, say di viral video wey show am dey interact wit students during interview no dey inappropriate.

Alli bin come under criticism afta di circulation of one video wey show am dey interact wit students during one interview.

Di video, wey don go viral on social media, trigger reactions from Nigerians, as pipo question Alli conduct during di encounter.

For inside di video, Alli wey currently dey represent Oyo South Senatorial District for di National Assembly, carry one student for leg during di interview.

As di student wey e carry for leg dey ask am questions, Alli dey respond and dey rub im thigh. Some social media users don give different interpretations to dis interaction as online debate don begin.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

However, Alli campaign say di student and oda pipo inside di video na students of The Polytechnic, Ibadan, wey bin visit di politician to seek support for one of dia programmes and conduct interview wit am.

According to di campaign, di number of pipo for di venue pass di available seating capacity wen di students arrive, and dis make some attendees no get seat to sidon.

Di campaign say wetin happun na spontaneous and fatherly gesture afta e invite one of di students to sit on im lap so di interview fit continue.

Di campaign insist say di interaction no get sexual or suggestive undertone and accuse some online platforms of deliberately assigning inappropriate meaning to di video.

"E dey deeply unfortunate say political desperation don descend to dis level, wia ordinary interaction between a fatherly political leader and students wey come seek support for dia programme dey deliberately twisted into somtin sordid," di campaign organisation tok.

Who be Senator Sharafadeen Alli?

Sharafadeen Alli

Wia dis foto come from, Sharafadeen Abiodun ALLI/Facebook

Senator Sharafadeen Abiodun Alli (BSA) na Nigerian lawyer and politician wey dey represent Oyo South for di 10th National Assembly under All Progressive Congress (APC).

Dem born am for April 20, 1963, for Ibadan, and e hold LL.B., Master for Law, and PhD for Legislative and Strategic Studies, and dem call am to Bar for 1987.

Alli start im political career as di first elected Chairman of Ibadan North LGA (1991), later e serve as Secretary to di State Govment and Chief of Staff to ex-govnor of Oyo State, Rashidi Ladoja for 2005. E also chair Odu'a Investment Company from 2011 to 2014.

Alli enta di Senate for 2023, and na im be di Chairman of di Senate Committee on Electoral Matters.

E also be di Ekarun Balogun of Ibadanland and run di BSA Foundation for community development.

Recently, e advocate for ecological funding to tackle flooding, lead APC unity efforts, support President Tinubu 2027 bid, and promote di establishment of Federal Medical Centre for im district.