Pope say e 'no dey fear' Trump afta US president criticise am

Wetin we call dis Video, Watch: 'I no be fan of Pope Leo' Trump tok
    • Author, Robert Greenall
  • Read am in 4 mins

Pope Leo tok say e no get any "fear" for di Donald Trump administration and go continue to speak out against war afta di US president launch unusual and serious verbal attack ova im stance on di Iran conflict.

Donald Trump accuse di pope say e dey "WEAK on Crime and terrible for Foreign Policy". E tok am for im Truth Social post, but e later tell reporters say e no be "big fan" of di Pope.

Di Pope tell reporters wen e dey go Algeria say e no wan get into any debate wit Trump but e go continue to promote peace.

Di Pope na critic of di Iran war, afta e call Trump threat to destroy Iranian civilisation "unacceptable" and say make e find way to take find end to di conflict.

Pope Leo look thoughtfully down to di left of di picture during im visit to Algeria on Monday. E dey wear glasses, a papal skull cap and red robe.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Pope Leo dey currently visit Algeria as part of 11 days trip to Africa

In general, e dey rare for pope to directly address statements by world leaders.

E get more dan 70 million Catholics for di US, about 20% of di population. Dem include Trump Vice-President JD Vance.

Trump remarks dey come as di pontiff embark on 11 days trip to Africa, im second major foreign trip since dem elect am last year.

Di US president write for im Sunday post say make di Pope "get im act togeda" and say e dey "weak on nuclear weapons". E dey apparently refer to Tehran attempts to become nuclear power, as one of di reasons for di US and Israel going to war wit Iran.

E also suggest say di Pope dey elected "becos e be American, and dem tink say e go be di best way to deal wit President Donald J Trump".

"If I no dey di White House, Leo no go dey for di Vatican."

Wen reporters ask am to explain di post, e later say: "I no tink say e dey do veri good job, e like crime, I guess."

Trump add: "E be veri liberal pesin, and e be man wey no believe in stopping crime, e be man wey no believe say we suppose dey toy wit kontri wey want nuclear weapon so dem go fit blow up di world."

Pope Leo reply Trump

For im response, di Pope tell reporters for im plane to Algiers say e no dey see im role as dat of politician but as one of spreading di message of peace.

"I no dey fear di Trump administration, or speaking out loudly of di message of di gospel, wey be wetin I believe say I dey here to do, and wetin di Church dey here to do," e tell reporters.

"I no want get into debate wit [Trump]," e add.

"Too many pipo dey suffer for di world today. Too many innocent pipo dey kpai. And I tink someone gatz stand up and say: e get beta way to do dis."

Trump remarks also draw criticism from Catholics around di world, wit one sabi pesin wey dey compare di comments to di Pope relationship wit fascist dictators for World War Two.

"Not even Hitler or Mussolini attack di Pope so directly and publicly," Reuters quote Massimo Faggioli.

Di Pope don use plenti public address to reject global conflicts and urge de-escalation for di Middle East.

Wen Trump threaten Iran and say "a whole civilisation go die tonight", e respond by saying di statement dey "truly unacceptable".

Di Pope don also criticise Trump hard-line immigration policy, questioning weda e dey possible for pesin to be "pro-life" - term wey dey normally associated wit opponents of abortion - if dem agree wit wetin e describe as di "inhuman treatment of immigrants".

Pope Leo dey seen as pesin wey dey continue di humanitarian tradition of im predecessor Pope Francis, wey tok say Trump "no be Christian" during di 2016 election campaign becos of im anti-immigrant language.

Trump describe di late Pope as "disgraceful".