'Na unspecified number of pipo suspected terrorists kidnap for Niger State' - Police

Wia dis foto come from, AFP via Getty Image
Niger State Police command don confam say suspected terrorists enta one community for di state on Friday, 21 August, 2026.
Di jaguda pipo enta di village for evening wia dem kidnap pipo wey dey for mosque dey observe dia prayers but some of dem escape enta nearby forest.
Niger State police Command tok-tok pesin Wasiu Abiodun confam di tori and im explain wetin happun.
"On 21/08/2026 at about 4pm, we receive report wey indicate say on same day at about 2pm, suspected terrorists bin enta Gidan-Zana, Kpenya village via Dekara District Borgu, and Kpenya mosque and abduct unspecified number of pipo during prayers while oda escape into di nearby forest," Abiodun tok.
Oga Abiodun add say from di tori wey dem get, nobodi kpai and dem don send security pipo go di area for assessment and to try rescue dem.
"However, developing report indicate say nobodi die, while dem don send joint security detachment go di area for assessment and rescue operations."
Dis dey come afta one video dey spread online. Di video show face two days afta di suspected terrorists kidnap di victims wey bin dey do dia usual Friday prayers for mosque for Dekara village.
For di video, one of di suspected terrorists bin dey send message to di families of di pipo wey dem kidnap.
E tell dem to identify dia relatives among di pipo wey dey inside di video.
"Na your pipo be dis. We dey show you dis video so dat you fit identify your family members, your papa, mama, pikin dem and relatives," na wetin di gunman tok.
Di Niger State police say dem still dey try to verify di video and di mata dey veri sensitive.
Di BBC neva independently verify dis video too but tori be say some pipo wey dey di village wey don see di video don identify some of di victims.
"Di pipo for di video come from Dekara. I don identify 13 pipo wey I sabi," Ibrahim Abubakar tell Reuters.
Anoda community pesin, Abdulmutallib Muqaddas Dindi, say, "We don identify our elders, relatives, and some of us don see dia wives and children for di video," im tok.
Anoda pesin for di community, Jamilu Ibrahim, dey beg security pipo for di federal and state level to help rescue dem.
Di video show mothers wit dia small children, men and elderly pipo wey di suspected terrorists kidnap.
Kidnapping for Nigeria don turn to anoda tin for di West African kontri. E don dey regular to di extent wey two months go hardly pass witout any kidnapping incident.
E neva tey wey Nigeria security pipo do collabo to rescue di victims of Orire kidnapping wey include teachers and schoolchildren.
Three suspects bin land for prison afta court sama dem life imprisonment. Dis na afta di Nigeria govment drag dem go court wit nine count charges wey all of dem plead guily sharp-sharp.
One army official kpai for di rescue mission as security pipo bin tell di public how dem manage rescue dem.
Dis na just one of di plenti kidnapping cases wey dey happun for different parts of di kontri.
Nigeria President, Bola Tinubu dey change security oga dem for di kontri so dem go fit reduce di insecurity challenges for di kontri but e be like say di more dem dey try, di more di jaguda pipo dey increase.
For May, gunmen kidnap ova 50 pipo for Borno State. Di questions many Nigerians dey ask na wen dis kidnapping go end?










