Which training Nigerian military dey receive from US and di impact on di fight against insurgency

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI/AFP via Getty Images
United States govment don outline di kind training dem dey equip Nigerian military forces wit to help dem tackle insurgency and insecurity challenge wey dey confront di kontri.
US African Command (Africom) for one statement on Monday, 24 August say dia 13th Combat Sustainment Support Battalion recently train Nigerian Air Force Special Forces on UAS operations, and dem teach dem how to integrate aerial tech into tactical missions.
Di training dey happun for Bauchi state, northeast Nigeria, one state wey insurgent groups don carry out several attacks, wey don lead to destruction of lives and property.
"Through combined training, advising, intelligence sharing and professional exchanges, U.S. and Nigerian forces don work togeda to address shared security challenges and improve interoperability. Even though individual U.S. teams perform different functions, each contribute to di broader partnership between di United States and Nigeria," Africom tok for di statement.
Wetin dey involved for di US/Nigeria military training
Capt. Gabriel Feingold, one logistics officer wey dey assigned to U.S. Army Southern European Task Force, Africa and di operations officer for OL Bauchi, tok say di U.S. units bin identify di training dem fit provide and coordinate dos opportunities wit Nigerian leadership.
"We bring dem one list of several different training topics, and dem select wetin dem think say go benefit dem di most," Feingold tok.
Feingold add say di approach dey allow training to draw on the capabilities of di U.S. units for Bauchi while responding to areas of interest wey di Nigerian forces identify.
One area wey gada one particular interest na di unmanned aircraft systems.
Sgt. Mark Murphy, an intelligence analyst assigned to the 13th Combat Sustainment Support Battalion, led approximately 10 members of the Nigerian Air Force Special
Oda trainings include:
- Combat Lifesaver and Tactical Combat Casualty Care instruction,
- Weapons familiarization,
- Camouflage,
- Water treatment and testing,
- Explosive ordnance disposal, small-unit tactics and unmanned aircraft system training.
How many Nigerian Forces US train
Sgt. Mark Murphy, an intelligence analyst wey dey assigned to di 13th Combat Sustainment Support Battalion, lead 10 members of di Nigerian Air Force Special Forces Regiment through UAS training for OL Bauchi.
Murphy introduce di Nigerian service members to di system and explain dia operations dia techniques U.S.
E add say di system dey easy to learn. Afta I receive instruction basic controls, participants dey able to begin operating di aircraft themselves.
For February, about 100 US soldiers bin land for Nigeria to train di West African nation's armed forces and help dem wit intelligence for dia battle against growing security threats from Islamist militants and oda armed groups.
Di troops and equipment bin land for one airfield for di north-eastern state of Bauchi, Nigerian defence spokesperson Maj Gen Samaila Uba tok.
E clear am say US personnel no go involve for combat operations, wey come from di request of di government.
Di US Africa command say di training go beyond just to learn how to operate di aircraft, but also how dem fit use di information wey di aircraft collect for operations.
"Beyond developing technical skills, di training don also create opportunities for U.S. and Nigerian service members to interact more directly."
"E help build relationships between Soldiers and di partner force, especially at di lower levels."
Sergeant Murphy say e notice say change dey afta di UAS training. E say many of di Nigerian personnel wey attend di training dey already work around U.S. service members and di training give dem anoda point to connect.
US Africa command say dem don build good relationship wit di Nigerian forces and di personnel go train togeda more and share areas of interest.










