'I no believe say dis go be im last operation' - Papa of soja wey die for Oyo kidnap rescue operation

Wia dis foto come from, Isaac Ademe family
Di papa of di military officer wey die during di rescue operation of di Oyo kidnapped children and teachers say di death of im son na still shock to di family.
Twnety-eight-year-old Lt Felix Ademe Isaac na di Nigerian Army officer wey die wen dem go for di rescue operation of di schoolchildren and teachers wey terrorists kidnap for Oriire community for Ogbomoso, Oyo State, southwest Nigeria.
Master Warrant Officer Isaac Alabura wey follow BBC News Pidgin tok say e dey unbearable to hear of di death of im son for di line of duty.
Di papa of di late soja say dem come from Guyuk Local Govment for Adamawa State, and add say na dia dem suppose bury im son.
Oga Alabura wey also serve for di Nigerian Army during im time bifor e retire say Lt Ademe na im third son.
Di fallen soja bin join di NDA afta which dem promote am to 2nd Lt. Dem post am to Signal Regiment for 2 Division for Ibadan.
'I manage to compose mysef' - Papa of late soja
"Wen I call di family to come home, I no fit explain give dem becos dem just see me in tears and e dey terrible for my home dat day," e tell BBC News Pidgin.
Di late soja papa describe di kain atmosphere wey happun for im home di day wey e call di family to tell dem about di death of Lt Ademe.
Di papa say e just manage to control imsef wen dem inform am about di death of im pikin.
"How I feel dey beyond wetin I fit control, I manage to compose mysef to listen to di officer wey report di situation. E dey unbearable, as I look at our future."
E say na di commanding officer wey lead di operation enta di forest bin first call am to inform am about di death of im son.
"I tell am make e let me know how di arrangement go go. And e later tell me say dem go do meeting. I tell di commander say di family dey request for di bodi of di son."
According to di papa, e say di Army no first gree to dia request to release dia son deadi bodi.
E say im go prefer make dem bury im son for Yola, instead of Ibadan wia e dey serve.
"For di meeting e tell me say di GOC say dem no go release di bodi to us, but dem say dem go give am befitting burial, but I tell dem say I get regiment near me here.
"Di burial for suppose be for Yola, no be Ibadan. You no fit kill my son and bury am for your area, dat one dey unacceptable," e tok.
Dem lay Lt Ademe to rest wit full military honours for di 23rd Armoured Brigade Cemetery for Yola, on 10 July.
Papa recount last tok wit im late son
Oga Alabura recount di last conversation wit im son wen dem go do di rescue operation for di Oyo kidnap victims.
E say e guide im son for di operation and tell am make e no trust anyone for di frontline of di operation.
"I guide am for dis operation, I dey tell am wetin to do and wetin not to do, I tell am make e no too trust pipo even for dis operation."
Di papa also describe di kain pesin wey im son be bifor e die and di kain dream wey e get bifor e kpai.
E add: "I speak to am last around 7:14pm wen di incident happun, we speak about di situation for di forest and e tell me say dem dey make progress.
"I no believe say dis go be im last operation, I no believe say e go fall for service. We still dey in shock, we dey hope say we go dey relieved of di pain."
E say im son dream na to become general and also help make life easy for pipo through fighting and defending Nigeria.
"I miss evritin about am, e wan become general, E dey diligent, e get hope for im future."









