House of Reps panel clear Gbajabiamila afta investigation on 'fake agency' PFIPC

Femi Gbajabiamila

Wia dis foto come from, @speakergbaja

Published
Read am in 3 mins

Di Nigeria House of Representatives Ad Hoc Committee don clear di Chief of Staff to di President, Femi Gbajabiamila, of involvement for di activities of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council (PFIPC/PEAC).

For dia preliminary report, di committee say dem no find evidence say Gbajabiamila authorise, establish or participate for di activities of di 'fake agency'.

Dem say di evidence bifor dem show say di Chief of Staff bin take steps to alert security and investigative agencies and initiate administrative verification afta concerns about di organisation bin reach im dormot.

Di committee say dem no find evidence say Gbajabiamila sign di purported appointment letter presented as evidence say Adeyemi don dey appointed as Director-General of di PFIPC/PEAC.

Di panel say no be di Chief of Staff issue or sign di document wey dey falsely attributed to di Presidency.

Di committee commend Gbajabiamila for wetin dem describe as timely security and administrative interventions afta concerns about di purported organisation bin reach im dormot.

Di chairman of di House of Representatives Ad Hoc Committee wey bin investigate di alleged inclusion of di 'fake agency' for di federal govment 2026 budget, Yusuf Gagdi, say di panel investigate dismiss claims say di panel only focus dia investigation on PFIPC/PEAC.

Gagdi tell Channels Television Politics Today say di committee investigate evrione wey dey connected to di controversy.

E say di probe bin dey guided by evidence rather dan identities of pipo wey dey involved.

"You no fit say wey bin investigate Adeyemi but no investigate Gbajabiamila, we investigate evribodi," Gagdi tok.

BBC News Pidgin bin previously report say afta weeks of investigations, Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) finally submit dia report to President Bola Tinubu ova di alleged fake agency as dia one month deadline by di president end.

Di commission tok say federal govment no send any money to di 'fake agency' wey dey linked to Adeniyi Adeyemi, di director-general of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council (PFIPC/PEAC)

For February, Nigerian govment bin expose di 'fake agency' wey Adeyemi dey run. At di time Adeyemi bin point finger to Femi Gbajabiamila wey be President Tinubu Chief of Staff as pesin wey facilitate im appointment and sign im appointment letter.

Dem later charge Adeyemi to court. During di trial, Justice Mohammed Umar of di Federal High Court for Abuja order for immediate arrest, days later, Nigerian authorities confam say dem don arrest Adeyemi.

For July, President Tinubu order ICPC say make dem investigate di mata and submit dia report within 30 days.