Wetin be ICPC findings and recommendations to federal govment as dem finish investigation on Adeniyi Adeyemi 'fake agency' PFICP

Wia dis foto come from, Bayo Onanuga/X
Afta weeks of investigations, Independent Corrupt Practice and Other Related Offences Commission (ICPC) don finally submit dia report to President Bola Tinubu ova di alleged fake agency as dia one month deadline by di president don end.
Di commission tok say federal govment no send any money to di 'fake agency' wey dey linked to Adeniyi Adeyemi, di director-general of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council (PFIPC/PEAC)
For February, Nigerian govment bin expose di fake agency wey Adeyemi dey run. At di time Adeyemi bin point finger to Femi Gbajabiamila as im accomplice, wey di President Tinubu Chief of Staff deny.
Dem later charge am to court, during di trial Justice Mohammed Umar of di Federal High Court for Abuja order for immediate arrest, days later Nigerian authorities confam say dem don arrest am.
For July, President Tinubu order ICPC make dem investigate di mata and submit dia report within 30 days.
Days later, di National Assembly agree to investigate how PFIPC take get di allocation of 1.302 billion ($954) allocation for di 2026 Appropriation Act even witout any legal backing.
ICPC findings
Di ICPC chairman, Musa Aliyu speak wit tori pipo on Thursday about wetin dem find out as dem torchlight di fake agency mata.
Aliyu follow tori pipo tok afta e don meet wit Presido Tinubu for inside di State House and submit di investigations report to am.
Here na summary of wetin di ICPC find out:
- Di letter of appointment wey oga Adeniyi Adeyemi tok say Femi Gbajabiamila sign and issue to am, na fake and e no even come from di president office
- Di so-called Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council no get any legal backing by di national assembly or any executive order by di president.
- E get two more fake govment agencies wey dey linked to Adeyemi, di fake director general. Dia name na: FCT Investment Promotion Agency (FIPA) and Foreign Investment Promotion Agency and Public Private Partnership (FIFA-PPP).
- Federal Government no approve or disburse money to di fake PFIPC/PEAC.
- Adeyemi also forge legislative instruments or "Enabling Acts" wey e bin use to open Bank Accounts in di name of di fake agency
- ICPC no find any weaknesses for di systems of di State House or CBN and di processes dey clear.
ICPC recommendation

Wia dis foto come from, Prince Adeniyi Adeyemi/Instagram/icpcnigeria/Instagram
Following all di tins wey dem find out about dis fake agency, di anti-corruption agency ICPC make di following recommenadations to di govment:
- Make di fake director general of PFIPC, Adeniyi Adeyemi face full prosecution
- Make presido Tinubu impose administrative punishment to public officers wey allow di fake PFIPC/PEAC to carry out illegal activities, sake of dia negligence
- ICPC also recommend stronger institutional reforms to prevent somtin like dis make e no hapun again
Di ICPC oga, Musa Aliyu, also tok say dem still dey investigate all di activities wey Adeniyi Adeyemi and im collaborators bin carry out as di so-called DG of PFIPC, and dem still dey torchlight all di accounts wey di fake agency bin create for different banks.
Brief background

Wia dis foto come from, Bayo Onanuga/X
Nigerian govment bin first expose dis fake agency - PFIPC/PEAC - wey Adeniyi Adeyemi bin claim say e be di Director General, and di Presidency tok say di agency no be lawful federal agency, even though dem dey operate from di Federal Secretariat, get official bank accounts and letters show say dem get approvals from di Head of di Civil Service of di Federation.
Adeyemi bin deny di allegations and insist say im appointment no be wayo. E claim say na di Chief of Staff to di President, Femi Gbajabiamila bin facilitate im appointment and sign im appointment letter.
Oga Gbajabiamila don since deny di claim and file ogbong court case against Adeyemi for libel.
However, police authourities say dia investigations reveal say Adeyemi represent imself as di director-general of PFIPC and im run di operation alone.
Dem later charge am to court bifor Justice Mohammed Umar of di Federal High Court for Abuja, who order make police arrest Adeyemi as e refuse to show for court.
Dat same evening, di Police confam say dem arrest am, dey wait for September 30 wen dem go carry am to court to face im eight-count charge of forgery and impersonation.
For July, di House of Representatives form committee to investigate how di supposed PFIPC take get allocation of N1.302 billion for di 2026 budget, even wen dem no get any legal backing.
For one of di investigative hearing, di Head of di Civil Service of di Federation, Didi Esther Walson-Jack, take responsibility for approving recruitment for di fake agency, PEAC/PFIPC.
Walson-Jack admit say her office no try as dem fail to do di necessary background checks bifor giving critical approvals to di 'fake agency'.
"My office bin receive di letter of appointment and di establishment act, and based on dose documents and also based on interactions wit di representatives of di PEAC/PFIPC, dem go on to issue di authorised establishment, and later di recruitment waiver.
"As we don see all di fact and observe all di document , we concede say we suppose carry out more due dilligence in di discharge of di duties of di office in issuing authorised establishment and recuitment waiver to di PEAC/PFIPC," Madam Walson-Jack tok.
Also, one director from di office of di Accountant General of di Federation, Joshua Luka, tell di House Committee say na one of im junior officers no do wetin e suppose do, as e allow Mr Adeyemi to take one letter wey suppose dey forwarded to di office of di State House Permanent Secretary.
However, Mr Adeyemi wey suppose also attend di hearing to tok im own side, no show face as di Inspector General of Police tok say di matter don already dey bifor court, and dem gatz need court order bifor dem go produce di suspect.
Las las, di House of Reps committee, wey dia Chairman na Yusuf Gagdi, lawmaker representing Kanke/Kanam/Pankshin Federal Constituency of Plateau State, reach conclusion say Adeyemi na di mastermind of di fraud and recommend im prosecution.
In response, Adeyemi lawyer, Festus Akhigbe tok say dem deny im client im right of fair hearing just bicos dem wan make a "scape goat".
Akhigbe point accusing fingers at oda govment agencies like di Central Bank or Nigeria, di Economic and Financial Crimes Commission, di office of di Secretary to di Govment of di Federation, and di office of di Head of Service, wey e claim say dem also dey complicit for di scandal.










