You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria university expel students ova accuse of gay practice
Di management of Confluence University of Science and Technology (CUSTECH) for Osara, Kogi state, northcentral Nigeria don approve di expulsion of two students on top accuse say dem dey practice gay.
Dem also suspend four oda students for one academic session sake of say dem fight for campus.
Di school management wey announce di informate for statement on Friday, 24 August, tok say dem approve di disciplinary measures for di 31st Regular Meeting of di University Senate afta dem consider recommendations from di Students' Disciplinary Committee.
Di Deputy Registrar Academics Eli Gbadafu for letters wey e address to di affected students say di institution take di disciplinary actions in accordance wit di provisions of di Students' Handbook, Second Edition, as amended in 2025.
Di University name di students wey dem expel say one of dem dey study Biology Education and di oda Mining Engineering.
Di students wey dem also suspend for fighting na females for di department of of Biochemistry, Biology and Microbiology.
Management warn say dem no go hesitate to take decisive disciplinary action against any student dem guilty of violating di rules and regulations of di university.
"Students are therefore advised to familiarise demsefs wit di provisions of di Students' Handbook and conduct demsefs in accordance wit di established rules and regulations of di university, di statement add.
End of Di one wey oda users dey read well well
Nigeria na one of di several African countries wia dem dey criminalise same-sex relationships.
Di kontri Same-Sex Marriage (Prohibition) Act, wey dem sign into law for 2014, bin introduce one14-year prison sentence for anyone wey enat same-sex marriage or civil union.
Di law also criminalise public displays of affection between same-sex couples, and e serve penalties of up to 10 years in prison, and banned gay clubs, societies and organisations.
Plenty human rights groups don condemn di law, wey dem say don contribute to increased discrimination, violence and extortion wey target LGBT pipo.
One report by Human Rights Watch say di bin "officially authorise abuses against LGBT pipo, wey effectively make a bad situation worse".
Activists say reports of attacks, mob violence and blackmail against LGBT Nigerians remain common, as some argue say di legislation don create environment wia such abuses fit occur with less accountability.
Across Africa, several countries don recently introduce or strengthened anti-LGBT laws.
Ghana parliament recently pass one controversial anti-homosexuality bill, although e neva bicom law.
Uganda get some of di continent harshest legislation, wey include possible death sentence for wetin dem define as "aggravated homosexuality" and life imprisonment for some same-sex relationships.
Burkina Faso and Niger don also recently adopt stricter laws wey target same-sex relationships.
Nigeria anti-LGBT legislation don previously receive significant public support, and di kontri remain one of di most restrictive environments for LGBT pipo on di continent.
For parts of northern Nigeria, wia Islamic law dey operate alongside di national legal system, same-sex acts fit also carry severe penalties, wey include di death sentence under some interpretations of Sharia law.