You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
After US and Iran no deal, Trump wan block Strait of Hormuz - Wetin to know
After di US and Iran no reach agreement ova di weekend, US President Donald Trump don threaten say US go start blockade for di Strait of Hormuz.
Nigerian military defend Jilli airstrike, say na terrorist camp dem target after reports claim civilian casualties
Di Nigerian Army for statement confam say dem carry out "precision airstrike on one known terrorist enclave and logistics hubs wey dey located near di abandoned village of Jilli.
Benin Republic dey vote to elect new President
Voters for Benin, one of West Africa most stable democracies don head to di polls on Sunday to elect a new president for a seven-year term.
US-Iran peace negotiation end without agreement
Officials from both countries bin meet earlier wit Pakistan Prime Minister Shehbaz Sharif.
Nigeria publish list of suspected sponsors of terrorism
E no specify dia nationalities, levels of involvement, or di groups dem belong to. Oda ogbonge informate like foto to identify dem plus dia gender no also dey.
Artemis II astronauts return to Earth afta 10 days historic trip around moon
Dis na di crew debut flight as part of a series of Artemis missions wey aim to return astronauts to di lunar surface wey go start for 2028.
Pope dey bring message of unity and peace as e visit African kontris - pipo tok wetin dem dey expect
Pope Leo XIV Africa tour na di longest international trip since e become pope.
'We wey dey alive, na God keep us' - Sojas wey survive Boko Haram attack for Borno tok afta Gen Braimah death
One Brigadier General for di Nigeria army folo for pipo wey kpai for di boko haram attack on Thursday.
Special Tori
Pope say e 'no dey fear' Trump afta US president criticise am
Donald Trump accuse di pope say e dey "WEAK on Crime and terrible for Foreign Policy".
How Ghana footballer Dominic Frimpong die inside late night armed robbery attack on team bus
Di football community for Ghana dey mourn death of 20-year-old Berekum Chelsea striker Dominic Frimpong wey die afta armed robbers attack dia team bus for night afta league game.
Di Ghana prophet and di mysterious death of im wife Charmain Speirs
One BBC Disclosure investigation don expose significant questions about wetin happun for di hotel wia Charmain die.
Women no suppose give birth wen dem lie down wit dia back
E dey more dangerous for women to give birth wen dem dey lie down, So why dem dey do am? Na sake of one Frenchman wey decide say e dey more convenient – for men.
All you need sabi about 2026 UTME examination
Dis slips contain candidates exam date, venue, and oda important details.
Melania Trump deny link to Jeffrey Epstein and call for hearing for survivors
Di president bin tell tori pipo MS Now say e bin no know abount im wife statement bifor e happun.
Terrorists kpai Brigadier General Oseni Braimah as Nigerian Army confam deaths of sojas for Borno
For one statement wey di Director of Defence Media Operations, Major General Michael Onoja, sign on Thursday 9 April, di military say di incident happun around 12:30 am for di Brigade Headquarters for Benisheikh.
US plan to dey register young men automatically for military draft eligibility
Di proposed new rule go end decades of mandatory self-registration for Selective Service in di US.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.