After US and Iran no deal, Trump wan block Strait of Hormuz - Wetin to know

    • Author, George Wright
    • Author, Rachel Clun
    • Role, business reporter
  • Read am in 7 mins

As di US and Iran no reach agreement ova di weekend, US President Donald Trump don threaten say US go start blockade for di Strait of Hormuz - e say military blockade of maritime traffic wey dey enta and come out from Iranian ports go start on Monday.

US President Donald Trump don tok say direct talks wit Iran for Pakistan fail becos Iran dey "unwilling to give up dia nuclear ambitions" - but one US official tok say dem get longer list of disagreements, including on Iran control of di strait.

Di plan na to make Iran oil economy collapse but dis blockade go also stop Iran from collecting money from oil tankers wey wan use di waterways.

Strait of Hormuz na important waterway, about 20% of global oil dey pass through – and di closure by Iran don drive up oil prices and di world economy don dey impacted.

Di strait na Iran most effective weapon for dis war against di US, since di war don start on 28 February, Iran don block di waterway.

Di US president threat don put global market for uncertainty, many kontris don dey struggle to meet di oil demand already and dem don begin put restrictive measures to help sustain di reserve for dia citizens as di war don dey go on for more dan six weeks.

US tok say ships wey dey come or go from oda places fit pass through di Strait of Hormuz, one critical water way wey Iran effectively close in response to US-Israeli strikes.

Dis dey come afta both fail to reach di deal wey go end di war, wey don start on 28 February but now dem dey under two-week truce.

Wetin Trump tok about di blockade?

Trump write for social media on Sunday say US go start "BLOCKADING any and all Ships wey dey try enta or comot from Strait of Hormuz".

"I don instruct our Navy to seek and interdict every vessel for International Waters wey don pay toll to Iran. No one wey pay illegal toll go fit pass safely for high sea," e tok.

E add say US go start to destroy di mines e tok say Iran don lay for di strait.

"Any Iranian wey fire at us, or at peaceful vessels, go dey BLOWN TO HELL!" e continue.

Trump say "at some point" dem go reach an agreement on free passage but "Iran never allow am to happen by merely saying, 'There fit be mine out dia somewhere,' wey nobody know about but dem".

E add for anoda post say "Iran promise to open di Strait of Hormuz, and dem knowingly fail to do am".

"As dem promise, dem beta start di process to open INTERNATIONAL WATERWAY SHARP SHARP!" e tok.

How di blockade go work in practice?

Di US Navy Commander handbook on naval operations law from 2022 define blockade as "belligerent operation to prevent vessels and/or aircraft of all states, enemy and neutral, from entering or exiting specified ports, airfields, or coastal areas wey belong to, wey dey occupied by, or wey dey under di control of enemy state".

Trump tok say di US Navy go begin di process of blockading di strait "effective immediately".

Di US Central Command (Centcom) later tok say dem go start implementing di blockade at 10:00 EDT (15:00 BST) on Monday.

"Di blockade go dey enforced impartially against vessels of all nations wey dey enta or comot from Iranian ports and coastal areas, including all Iranian ports for di Arabian Gulf and Gulf of Oman," di Navy tok.

Centcom add say US forces no go disturb di freedom of vessels wey dey travel to and from non-Iranian ports, and dem go provide additional information to commercial mariners bifor di blockade go start.

Trump tok say oda kontris go dey involve in blockading di strait, but e no mention which one. Di BBC understand say di UK no go dey part of di blockade.

Trump also tell Fox News say Nato don offer to help "clean out" di strait, e add say e go dey free to use again "e no go too long".

Trump tok say di US go bring minesweepers, and say di UK - wey be member of Nato - go bring too.

Prime Minister Sir Keir Starmer don bin tok say British military mine-hunting systems don dey already for di region.

One UK govment tok-tok pesin tok say: "We dey work fast wit France and oda partners to put togeda wide coalition to protect freedom of navigation."

However, Sir Keir don tok say di UK no go join di US blockade.

Three legal experts for di US tell BBC say blockade fit violate maritime law. One also question weda di blockade, wey dey enforced militarily go violate di current ceasefire agreement.

Why US go blockade di strait?

Geography of di strait don allow Iran to use am as leverage for dis war, dem dey prevent some vessels from passing through di narrow waterway and dis process don push oil prices up.

Tehran don dey charge big money from some vessels wey wan pass through.

If dem close di strait, Trump fit cut off significant source of revenue for Iranian govment - but dis fit make oil and gas prices to rise even higher.

E tell Fox News say "we no go allow Iran make money by selling oil to pipo wey dem like and no be pipo wey dem no like", di goal na to allow "all or nothing" pass through dat important shipping channel.

Analysts don suggest say di US president statement aim to put pressure on Iran make dem agree for American terms.

Republican Congressman Mike Turner tell CBS say di blockade na way to force resolution for di situation.

"Di president, wen e tok say we no go just allow dem choose who go pass, dey call all our allies and everybody to di table," e tok.

But Senator Mark Warner of Virginia, di ranking Democrat for di Senate Intelligence Committee, tell CNN say: "I no understand how blocking di strait go push di Iranians to open am."

Wetin di impact go be?

For now, Trump don threat to blockade di strait go only affect small number of vessels wey still dey navigate di waterway, shipping expert Lars Jensen tell BBC.

"If di Americans do am, e go stop di flow of small vessels. For di bigger scheme, e no really change anytin," e tok.

Jensen, chief executive of Vespucci Maritime, tok say Trump threat to stop safe passage for any ship wey dey pay tolls to Iran go also no get much impact, as any company wey do am go dey face sanctions for paying di regime.

Most shipping companies go continue to dey wait make dem see weda peace agreement go fit hold, Jensen tok. If dat hapun, slow resumption of shipping fit start.

Wetin be di current situation for di strait?

Two-week ceasefire for US-Israel war wit Iran wey dem agree on 7 April include one condition say dem go secure 'safe passage' through di narrow waterway.

However, vessels for di area come receive messages say dem go dey 'targeted and destroyed' if dem try cross di strait without permission, and only few ships make di journey for di first three days afta dem announce di ceasefire.

By 17:00 BST on 10 April, only 19 ships don pass through di strait since di ceasefire, according to BBC Verify analysis of ship-tracking data from Marine Traffic.

Out of dem, four na tankers wey dey carry either oil, gas or chemicals. Di rest na bulk carriers or container ships of various types.

Oda ships don pass di journey witout broadcasting dia location.

Bifor di conflict start on 28 February, on average, na 138 ships dey pass through di strait every day.

Additional report by Sareen Habeshian