You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
More money for Wafcon winner, Afcon go expand to 28 teams - Caf introduce reforms for African football
Caf President Patrice Motsepe don confirm say Africa Cup of Nations go expand to 28 teams from di 2027 edition, wey Kenya, Tanzania and Uganda go host from June 19 to July 17, 2027.
Motsepe tok say di increase show Caf plan to further grow di tournament, afta dem already change di competition from evri two years to evri four years.
Under di new format, di group stage go get seven groups of four teams. Caf say dem go soon make di qualification system clear.
Di 2027 Afcon qualifiers go happun across three international windows: September 21 to October 6, 2026; November 9 to 17, 2026, and March 22 to 30, 2027.
Motsepe also announce one major increase for di prize money of di 2026 Women's Africa Cup of Nations.
Di winner now go receive $2 million, up from $1 million, while each of di 16 teams wey qualify go receive at least $150,000.
E also praise African teams wey participate for di 2026 World Cup and tok say e personally support FIFA president Gianni Infantino ahead of im re-election bid.
Mali, Niger, Burkina Faso don bid to host AFCON 2032
Mali, Niger and Burkina Faso three kontri wey military govments dey rule don submit joint bid to host di 2032 Africa Cup of Nations.
Malian Football Federation tok for one statement say officials meet wit Confederation of African Football (CAF) president Patrice Motsepe on Saturday for New York "to discuss dia joint bid to host di 2032 Africa Cup of Nations".
Di three neighboring kontri and allies under di Alliance of Sahel States (AES) dey under juntas wey take overpower after coup, and dem still dey battle insecurity as deadly jihadist groups attacks don kill thousands of pipo.
Di Malian federation tok say di meeting wit Caf mark "one important stage for di bidding process", wey go allow di three member associations "to kontinu wit di steps wey CAF regulations outline for awarding di 2032 Afcon."
Di statement add say di three federations go continue "di work wey dem need to prepare one strong and credible bid wey go represent one new vision for African football."
Burkina Faso don host Afcon bifor for 1998, while Mali host am for 2002. Niger never host di biennial tournament bifor.
Mali get five stadiums wey Caf don approve, while Burkina Faso secure approval for dia main stadium for Ouagadougou for 2025.