Why Appeal Court cancel sections of di Electoral Act wey concern primary and membership register

Foto of Nigeria president Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency/X

Published
Read am in 3 mins

Di Court of Appeal for Abuja, Nigeria capital don cancel some sections of di Electoral Act 2026.

Appeal court cancel di sections sake of say dem no match wit some provisions of di 1999 Constitution.

Section of di Electoral Act 2026 wey court cancel include Sections 77(5), (6), and (7) and Section 84(2).

For dia unanimous decision on Thursday, di court rule say subsidiary law no go fit disqualify any individual wey di constitution don already qualify.

Na Justice Balkisu Bello Aliyu lead di panel and wife of di FCT Minister, Justice Eberechi Nyesom-Wike read di lead judgement.

Di Appeal Court say Sections 177 and 182 of di 1999 Constitution bin don already list how pesin for political parties or candidates fit qualify or dey disqualified for any election.

Appeal Court rule say di National Assembly no go fit impose restrictions on di powers of political parties wey di constitution already guarantee.

Appeal Court say Section 84(2) of di Electoral Act 2026 dey unconstitutional sake of say e dey seek to limit political parties to direct primaries or make dem to choose consensus mode.

According to di Appeal Court, di section dey cause undue legislative interference for di internal affairs of political parties.

Di court of appeal also tok say dem no cancel di whole section 77 and 84 of di Electoral Act but di area wey allow political parties to maintain membership register still dey valid.

Di sections wey dis ruling affect focus on di process wey political parties dey use nominate candidates and dia membership register.

Section 77(5) tok say “Only members wey dia names dey for di register dey eligible to vote and be voted for during party primaries, congresses and conventions.”

Section 77(6) say “ Political party no go fit use any oda register for party primaries , congresses and conventions except do register wey dem submit to di commission.”

Section 77(7) say “Any party wey fail to submit di membership register within di particular time no go fit field any candidate for di election.”

Section 84(2) say “Di procedure to nominate candidates by political parties for di various electI’ve positions go be by direct primaries or consensus.”

Wetin bring dis mata?

Zenith Party for Nigeria wey pipo sabi as Zenith Labour Party(ZLP) bin go court sake of di Electoral Act 2026.

Di party go Appeal Court wia dem tell di court to dismiss di suit wey dey challenge di legality of some provisions of di Electoral Act 2027.

Tori be say for May 2026, one Federal High Court Judge, Mohammad Umar bin dismiss ZLP case say e lack merit.

Di party carry dia mata go appeal court wia dem ask di court to determine weda wetin dey inside Electoral Act get ogbonge power pass di power wey political parties get inside di constitution.

Dem also tell di appeal court to determine if di electoral law no dey try to collect do right of political parties to choose how to conduct dia internal mata.