Health authorities restart care response afta family members break into Ebola centre carry deadi bodi run for DR Congo

Published
Read am in 5 mins

Di Alliance for Medical Aid (Alima), wey be international medical NGO, don condemn di endangerment of human lives and destruction of essential medical facilities wey dey needed to ensure di safe care of patients, wey happun for di Democratic Republic of Congo on Thursday, 21 May.

Dis dey come afta two tents wey dey dedicated to di care of patients wit di Ebola Virus Disease bin dey set on fire for Rwampara Hospital, for Ituri.

Alima say dia teams still remain fully mobilised on ground and dem dey do evritin possible to ensure continuity of care, protect patients, and support di teams wey dey involved in di Ebola response.

Dem also dey warn against di spread of incorrect or unconfirmed information wey dey likely to fuel fear, misinformation and mistrust towards health facilities and teams wey dey involved in di Ebola response as dem say,

"for dis kain sensitive context, to dey share verified information dey essential to protect communities and ensure access to care."

Di international medical NGO add say dem dey join bodi wit health authorities and partners to implement immediate measures wey go limit di impact of di fire incident wit some measures dem don put in place.

Dis include di temporary reorganisation of di care areas, securing medical activities, redeployment of essential equipment, preparation of alternative solutions to ensure di continuity of patient care and to ensure di security of health workers.

How kasala happun?

Health officials for di Democratic Republic of Congo say kasala start for one Ebola treatment centre near di eastern city of Bunia afta family members of one suspected Ebola victim use force carry dia deadi bodi comot, despite warnings from medical staff.

Dis incident happun for di morning of 21 May, 2026.

During di kasala, six patients escape from di facility, including three wey get Ebola cases wey authorities don confam.

Dem also put fire for some parts of di Ebola treatment centre for Rwampara General Hospital.

E neva clear weda anybodi injure. Later, di military place medical workers under dia protection while police try to restore order.

Health experts warn say Ebola fit spread through contact wit di bodi of pesin wey di virus kpai becos bodily fluids remain highly infectious afta death.

Di World Health Organization recommend say only trained burial teams wey wear protective equipment go handle Ebola victims.

Authorities for di Democratic Republic of Congo say di outbreak don cause 159 probable deaths from more dan 600 suspected cases.

Police neva comment on Thursday incident.

Meanwhile, for anoda incident, DRC Congo cancel dia pre-World Cup training camp for Kinshasa, becos of di Ebola outbreak for di eastern part of di kontri.

DRC don shift dia preparations to Belgium, as di outbreak don cause di death of ova 130 pipo.

Di World Health Organization (WHO) tok say di outbreak na "public health emergency of international concern", but e neva reach pandemic level.

Jerry Kalemo, wey be di tok-tok pesin for di national football team, tell international media say di pre-tournament games for Europe go happun as dem dey prepare for dia first World Cup since 1974.

DR Congo go play friendly matches against Denmark, on 3 June for Belgium, and Chile, on 9 June for Spain, bifor di World Cup finals.

Dem go play dia first match for di tournament for Houston, US, on 17 June, against Portugal.

How you fit prevent Ebola virus

Wash your hands evri time wit soap and water - Health pipo say make we wash hands wit soap and water and clean surfaces wit chlorinated water.

No dey touch pipo wey don dey infected - To prevent more of di infection, health professionals advise make pipo avoid contact wit pipo wey dey infected, including for dem to stop to shake hands.

Avoid deadi bodi.

No dey kill, touch or chop bush meat.

Di Zaire strain of Ebola, wey dey common for di past for di Democratic Republic of Congo, get vaccine.

However, early treatment of specific symptoms, fit improve survival of di pesin wey get am.

For medical teams, dem must wear full Personal Protective Equipment, PPE, wen dem dey attend to cases to prevent infection. Deadi bodi inside any bodi bag gatz dey buried by pipo wey dey wear proper PPE.