Canadian province Alberta go hold referendum on weda dem wan stay inside Canada or comot

    • Author, Nadine Yousif
    • Role, Senior Canada reporter
    • Author, Sareen Habeshian
  • Published
  • Read am in 5 mins

Alberta go hold referendum on weda di province go remain inside Canada or if dem wan vote on dia separate, dis go be di first serious test on di kontri unity in many years.

Premier Danielle Smith annouce dis on Thursday afta one citizen-led petition wey dey call for separation gada more dan 300,000 signatures early dis year, and anoda petition wey dey support make Alberta stay don gada more dan 400,000.

Independence movement don dey grow for dis oil-rich province, becos pipo believe decision-makers dey overlook Alberta for Ottawa.

Still, opinion poll dey suggest say majority of Albertans go vote against separation.

Di provincial referendum go hold on 19 October, di premier tok.

Smith, for her televised address, tok say di question wey dem go dey ask Albertans dis autumn go be: "Make Alberta remain province under Canada or make di Govment of Alberta start di legal process wey dey required under di Canadian Constitution to hold binding provincial referendum on weda Alberta go separate from Canada?"

Di premier tok say she go vote make Alberta remain part of Canada.

"Na like dis I go vote for separation for di provincial referendum," she tok, add "dis na di position of govment and my caucus too."

However, she tok say she dey "deeply troubled" by di court decision wey one Alberta judge throway one petition wey dey call for di referendum on seperation afta di First Nations groups argue say dem no properly consult dem, dis infringed dia rights.

Dis stop di verification of di petition signatures, and e leave di potential of a referendum in limbo.

"As Premier, I no go let one legal mistake by one judge silence di voice of many Albertans," Smith tok on Thursday. "Na Albertans, go decide di future of Alberta, no be di court."

She add: "To dey push di matta no go do anytin but extend di emotional and important discussion, and to silence di voice of hundreds of thousands of Albertans wey wan make dem hear dem, e dey unjustifiable in a free and democratic society."

Smith don dey face months of pressure from separatist Albertans make dem put dia question for ballot.

Jeffrey Rath, lawyer wey dey fight for separation, write for social media on Thursday say Smith don deal wit referendum question "from di bottom of di deck".

E add say di premier don "just lose her base".

Canada unity don dey face wahala bifor.

Quebec don vote twice against independence, di last time na 1995 wey end wit small margin 50.58% to 49.22% "no" vote.

Di kontri don set rules for separation afta dat battle. Even if Alberta side wey wan "leave" succeed for October, long and uncertain road dey ahead.

Early May, Prime Minister Mark Carney tok say any attempt for di province to separate must follow di rules wey Clarity Act set - di 26-year-old law wey dem don put in place afta di 1995 Quebec referendum.

Possible second binding Alberta independence referendum go need follow ground rules wey dey for di Act, including "clear majority" of voters must dey in support, di language of di independence referendum question must dey clear, wit oversight from federal House of Commons.

If dem meet all dose conditions, Alberta go enta difficult and likely long separation negotiations wit di federal govment on di terms of di divorce.

Pipo for Ottawa don dey vex for long time in di western province wey get four million pipo, especially ova how dem dey handle di natural resources.

Some Alberta pipo believe say di federal govment dey block dem oil and gas industry for di province just to follow pro-climate law.

Dem also believe say di province wey get plenty resources, dey give more to di kontri pass wetin dem dey receive.

Previously on di political fringes, di possibility of unity crisis don become serious matta since last year.

While di separatist movement no get unified view, most of dem just wan see, at least, more freedom over di province resources and political priorities.

Smith don acknowledge some of di concerns wey pipo get on Thursday, as e dey argue say di federal govment don try to "move towards one centralised American-style system" and e dey infringe on di provincialjurisdiction.

"I categorically reject Ottawa attempt to do am, and I call all di provincial leaders and MPs make dem reverse di damage wey dis centralisation of power for Ottawa don cause for our economy and wit respect to national unity," Smith tok.

Carney don dey work wit Smith to address some of di concerns wey she get, including building pipeline wey go reach di Pacific coast.

Di two leaders don announce climate and energy deal earlier dis month wey fit allow dem start to build di oil pipeline as early as next year.

Dominic Leblanc, wey be Canada Minister for Internal Trade, tok for social media say di Liberal govment "strongly believe say di interests of Albertans and all Canadians dey serve wen we dey work togeda".

"As we dey listen to Premier Smith speech dis evening, we go remain focus on how to build strong Canada for all, we go partner wit Alberta to make sure all Albertans and Canadians benefit," e continue.

Pierre Poilievre, wey dey lead di federal Conservatives, na from Alberta, on Thursday e tok, e stand "for one united kontri, and we go campaign everyday and everyway to unite dis kontri around hope."