Muslims around di world dey celebrate Eid Mubarak

Members of the Muslim community in Mexico City dey pray

Wia dis foto come from, Gerardo Vieyra/NurPhoto via Getty Images

Published
Read am in 3 mins

Muslims around di world dey celebrate Eid two times evri year, and Eid al-Adha na di second of di two feasts.

E dey happun just over two months afta Eid al-Fitr, and na im be di holier of di two festivals.

Eid al-Adha dey start for di 10th day of Dhu al-Hijjah, wey be di final month for di Islamic Calendar.

E dey take place during Hajj, di Muslim pilgrimage to Mecca for Saudi Arabia.

Eid al-Adha dey last between three to four days. Di date of di festival dey change every year becos Islamic calendar dey based on di moon.

Wetin be Eid-al-Adha?

Eid al-Adha, wey mean 'festival of sacrifice', na one of di most important festivals for di Muslim calendar.

Di festival na in memory of di story of prophet Ibrahim, wey willing obey Allah wen e ask am to sacrifice im pikin.

Muslims believe say Allah stop Ibrahim bifor di sacrifice happun and provide sheep make im sacrifice instead.

Foto of Muslims wey dey chop togeda

Wia dis foto come from, Kazi Salahuddin Razu/NurPhoto via Getty Images

How dem dey celebrate Eid-al-Adha?

Muslims always start di celebration wit special prayers for mosques on di morning of Eid. Dem go wear fine cloths and thank Allah for all di blessings wey dem don receive.

E dey normal to wish each oda Eid Mubarak - wey mean "blessed Eid."

Children dey receive gifts and na also time for dem to visit family and friends.

Many Muslims dey mark Eid al-Adha by feasting on animals like goat, lamb, cow or camel. Some families dey do dis, while odas dey donate money to trusted charities wey go arrange di sacrifice and share di meat for dem.

Traditionally dem dey donate large part of di meat to pipo wey need am. Dem dey call dis practice Qurbani, or simply Eid sacrifice. Muslims go still give money to charity so that oda Muslims wey no too get money go fit celebrate Eid too.

How political leaders celebrate Eid Mubarak

Nigeria Senate President Godswill Akpabio wear red cap and white dress. E siddon ontop red chair with microphone for im front

Wia dis foto come from, Godswill Akpabio

Di President of di Senate, Godswill Akpabio, on call for unity, sacrifice, and national renewal as Muslims celebrate Eid Mubarak. D

Akpabio also send best wishes to President Bola Ahmed Tinubu, Vice-President Kashim Shettima, and all di Muslim faithful for Nigeria.

In side one statement on Tuesday, tok-tok pesin to di senate president, Eseme Eyiboh, tok say dis occasion dey call for prayers and reflection on di theme of sacrifice.

"Dis holy occasion dey remind us of Prophet Ibrahim faith, obedience, and im willingness to sacrifice for Almighty Allah.