Nigeria Football Federation President Ibrahim Gusau don resign

Ibrahim Gusau

Wia dis foto come from, Ibrahim Gusau

Published
Read am in 5 mins

President of the Nigeria Football Federation Ibrahim Gusau don resign from im position as president of di federation.

E make di announcement for di NFF Secretariat for Abuja, Nigeria capital on Thursday 27, August, 2026.

Im resignation dey come afta plenti tori bin fly upandan say im and some board members don resign.

E however confam di tori on Thursday for one news conference wit tori pipo.

Plenty Nigerians and administrators bin para say Nigeria football no dey go front since e enta office.

Gusau say e achieve plenti tins during im time as President of NFF.

E say im resignation come afta consultation wit necessary stakeholders and family members.

"Wen we win bronze fro Morocco, pio no complain becos pipo see hope. I dey proud to say I contribute to art of di success."

"I make consultation, I gatz tell, I decide to resign as President of NFF."

Di Nigeria Football Federation suppose hold dia election for September 2026, but many fans don even dey impatient bifor di time as dem tok say di NFF President, Gusau suppose resign even bifor di election.

Now wey im resignation don come, eye dey on who go take up di position of di Nigeria football govning body.

Plenti matter don dey ground bifor wey football fans don dey tok about di condition of Nigeria football.

Football lovers first para for social media afta di women national team Super Falcons fail to qualify for di Fifa Women World Cup wey go happun for Brazil, afta South Africa beat Nigeria 2-1 to qualify for di World Cup during di playoffs for Morocco.

Bifor dat time, Nigeria lose 2-1 to Cameroon for di quarter-finals of di Women Africa Cup of Nations wey be di reason why dem no get direct qualification to di World Cup.

During di press conference, Gusau say im name dey spread evriwia for different tok tok wey pipo dey carry about am.

E say during im administration as NFF president, e get tins wey im do to make di football situation better.

"On referees, we meet bad situation but we try our best to engage some young hands. Infrastructure na issue wey we meet on ground."

"We siddon and see say we lack infrastructure and accommodation for di players," Gusau tok during di conference.

"Di only reason why we no tok bifor now becos say we sign contract. My name dey spread evriwia, but I dey comfortable and I appreciate di opprotunity to serve di NFF."

Bifor now, NFF bin set up committee wey go chook eye inside football for di kontri and di wahala wey e dey face.

Di mandate of di six man committee na to find out why football no dey go well for Nigeria again.

Na afta many Nigerians dey para sake of how Nigerian football don fall yakata under di Ibrahim Gusau-led NFF.

While some pipo say make e resign as e don fail Nigerian football as dem accuse am say e dey carry football for di kontri dey go wia dem no know, odas tok say make Nigerians give am time for im second term to perform.

Wahala wey NFF president enta bifor e resign

Apart from di Super Eagles and Super Falcons wey miss out of di World Cup, di age grade football teams dey also struggle.

Di Nigeria under -17 men national team - di Golden Eaglets - wey bin don win di Fifa U17 World Cup five times bifor, no qualify for dis year edition wey go take place for Portugal from 19 November to 13 December dis year.

Den di U-20 men national team - di Flying Eagles - fit also miss out for di 2027 Fifa U20 World Cup for Azerbaijan and Uzbekistan. Dem lose to Burkina Faso 1-4 for di WAFU B tournament wey suppose qualify dem for di Caf U20 Africa Nations Cup.

Na dis Nations Cup also be di African qualifier for di U20 World Cup next year, bicos all di four semi-finalists for di tournament go qualify automatically.

So e mean say di Flying Eagles fit also miss di World Cup.

However, di Nigeria Football Federation don apply to Caf for special place for di U20 Nations Cup, based on some special consideration. Dat application still dey on.

Di only good news na di U17 women national team - di Flamingos - wey manage to secure qualification for di Fifa U17 World Cup wey go take place for Morocco from 17 October to 7 November 2026.

But now wey Gusau don resign as NFF president, di kwesion na how di football matter for Nigeria go become better and who go fit make am better.