Why Trump administration wan cancel B1, B2 visas of 200,000 asylum seekers and increase H-1B visa fee to ova $103,000

Donald Trump

Wia dis foto come from, Jim WATSON / AFP via Getty Images

Published
Read am in 5 mins

Di Trump administration dey plan to cancel di visas of foreign nationals wey bin enta di US as short-term visitors and later apply for asylum.

"Obtaining a visa in order to seek asylum na fraud – wey be grounds for visa revocation," US State Department spokesman Tommy Pigott tok.

Pigott say di number of revocations "remain dynamic" and go dey carried out on a rolling basis. US media reports suggest say hundreds of thousands of visas fit dey affected.

Since President Donald Trump take office, im administration don cancel more dan 175,000 visas of foreign citizens on various reasons, according to di State Department.

"Under President Trump and Secretary Rubio leadership, we dey make am clear say visa na privilege – no be right," Pigott tok for one statement to di BBC.

Meanwhile, United States, Department of Homeland Security (DHS) don propose to apply di fee of $103,265 to applicants of H-1B visas.

Dis na just proposal but e fit still change how employer go dey employ immigrants wey dey find work through di H-1B visa.

US govment still dey make di proposal but dem neva adopt am. Di federal register notice go come out on 25, August 2026 on dia decision.

Di $103,265 proposed charges go apply to H-1B cap-subject petitions, including petitions for workers wey qualify for di U.S. advanced-degree exemption.

Employers go pay di fees wey dem file di H-1B petition and dem go add am to di oda fees wey di visa require.

US federal law limit H-1B visas as dem only issue 85,000 H-1B visa every year. Extra 20,000 dey go to workers wey get master degree or higher degree from US institutions.

"DHS dey propose to establish $103,265 fee for all H-1B cap-subject petitions, eeven pipo wey dey eligible for di advanced degree exemption," DHS tok.

"Dem go pay di proposed fees wen dem dey file for am and dem go join all oda fees wey dey applicable."

"DHS dey estimate say di proposed fee go generate about $8.8 billion every year, base on projected 85,000 annual volume of H-1B cap-subject petitions."

DHS tok say di reason for dis proposal na to recover some money wey di federal govment don spend to make di immigration system legal.

DHS tok say di money go support immigration-benefit decisions, fraud check, national security screening, IT systems, records management and coordination between federal agencies.

E go also help activities wey concern U.S. Citizenship and Immigration Services, Customs and Border Protection, Immigration and Customs Enforcement, di Department of Justice, di State Department and di Department of Labor.

"Di proposed H‑1B fee na to recover costs wey federal government dey incur to adjudicate, vet, and support lawful immigration programs wey taxpayers suppose dey fund," US Citizenship and Immigration Services tok-tok pesin Zach Kahler tok.

DHS argue say employers wey dey file cap-subject H-1B petitions get greater ability to handle extra costs pass many individual immigration applicants. But di department admit say di increase huge and e fit make some employers, especially small businesses, file fewer H-1B petitions.

Who go pay di proposed fee?

Na di H-1B petitioner petitioner [employer] go pay wen dem dey file cap-subject H-1B petition wit USCIS.

E no dey apply to every H-1B worker wey don dey live or work for di United States already.

E no go automatically apply to every H-1B extension, transfer or cap-exempt filing.

"Under di proposed rule, di extra fee no go dey applied to H-1B petitions wey no fall under di cap, such as petitions wey certain nonprofit research organizations, governmental research organizations, and institutions of higher education file," DHS tok.

How di new proposal go affect Nigerians?

In 2024, American companies sponsor 880 Nigerian professionals for H-1B specialty worker visas compared to Indians Chinese and Australians wey account for more dan 80,000 applications. Di new proposal go increase costs for companies wey wan retain foreign workers on visas like H-1B visa for US, and hit Nigerian professionals go dey among di numbers wey go shrink further.

Alreday di H-1B visa cost between $2,000 and $5,000 bifor di proposal and di new proposal go impact professionals on H-1B visas becos majority of dem dey earn less dan $100,000 yearly salaries.

Since, di fees don pass di salary, many employers go search for foreign nationals wey don already dey for United States on student visas or oda visas.

Wetin be H-1B visa

H-1B visa dey allow American companies and employers to hire foreign talent for high-skilled jobs American workers no fit fill.

Dem dey issue 65,000 visas annually, including 20,000 for professional wey get advanced degrees, for three to six years term.

American big tech companies dey use dis program to employ professionals all ova di world.

Wetin Trump tok about H-1B visa?

Foto of US President Donald Trump

Wia dis foto come from, Francis Chung/Politico/Bloomberg via Getty Images

US president Donald Trump don first propose make American employers pay $100,000 in September 2025, as im wan prioritise American workers.

Before dis proposal, di fees dey between $2,000 to $5,000.

Trump believe say US companies dey use H-1B program to replace American workers wit cheap foreign labour.

However, unions don carry govment go court becos di fee wey Trump dey propose go affect US employers ability to hire global talent in di tech industry and medical industry wey don already dey struggle wit workforce.

In June, federal US District Courtt block Trump plan to enforce $100,000 fee. Di Judge also block Trump $142k skilled worker visa fee.

Trump administration dey tok say di planned fee for H-1B visa go stop foreign workers from taking American jobs.