Di big questions wey Nigerians dey ask afta Mene Ogidi extrajudicial killing by Nigerian police officer

Wia dis foto come from, Mene Ogidi
- Author, Tunde Ososanya
- Role, Senior Journalist
- Reporting from, Lagos
- Read am in 4 mins
Nigerians still dey in shock sake of di extra-judicial killing of 28-year-old Mene Ogidi by one police officer for Effurun, Delta State, south-south Nigeria.
Inside one video wey bin go viral on social media, Ogidi, wey dem tie for both hands and legs, sidon for floor wia police officers led by ASP Nuhu Usman bin dey interrogate am. Di young man dey beg, dey cry and dey tell dem say na im friend wey tell am to receive one parcel deceive am. E bin promise to take di officers to dat im friend wey e say dey for Sapele.
But di officers no listen and one of dem cock im gun and shoot Ogidi. Afta di shooting, dem put am inside dia vehicle. Di incident happun on Sunday 26 April.
Ogidi death don make pipo vex within and outside Nigeria and remind Nigerians about police brutality wey trigger di EndSars protest of 2020.
Inside one statement wey di Nigeria Police Force (NPF) issue on Tuesday 28 April, dem say, "Preliminary reports indicate say operatives wey dey attached to di Effurun Area Command bin respond to credible information from Benin Motor Park along di Warri-Sapele Expressway regarding one suspect wey members of one transport union gbab while e dey attempt to waybill one parcel wey contain one Beretta pistol wit four rounds of ammunition."
Di statement add say while efforts bin dey go on to take di suspect into lawful custody, di team leader, ASP Nuhu Usman discharge im firearm in clear violation of extant regulations wey result for di death of di suspect.
Inside anoda statement by di police, tok-tok pesin DCP Anthony Placid say di Force Disciplinary Committee don recommend di immediate dismissal of ASP Nuhu Usman and oda officers wey dem find guilty for Ogidi death.
"Di Inspector-General of Police don approve di recommendations and forward same to di Police Service Commission for ratification in line wit due process," e tok.
DCP Placid say afta di completion of di administrative procedures, di police go hand ova ASP Usman and di oda officers to di appropriate judicial authorities for di roles dem play for di extrajudicial shooting.
Questions wey Nigerians dey ask
Nigerians on and off social media wey watch di horrific video of di extrajudicial killing dey ask series of questions wey di Nigeria Police Force fit provide answers to.
Dis na some of di questions Ogidi extrajudicial killing don raise:
- Why be say dem treat suspect wey dem tie for hands and legs as immediate threat wey require lethal force?
- Wetin ASP Nuhu Usman and im team know about di parcel and di pesin wey send am, and why dem no follow due process?
- Shey standing orders or pressure dey from superiors wey influence ASP Usman actions?
- Why dem no take Ogidi into custody and investigate further, especially afta e offer to cooperate?
- Which role di transport union members wey gbab am play, and shey police go also question dem?
- How often dis kain incident dey happun witout recording or public knowledge?
- Which protections dey exist for suspects wey dey for police custody, and shey officers dey properly trained on dem?
- Why be say police brutality dey continue years afta di EndSars protest?
- Which reforms don dey truly implemented since past incidents, and shey di police dey enforce dem?
- Shey Ogidi family go receive justice?
- How citizens fit take trust law enforcement if dem fit kpai suspects wey dem gbab?
- Which safeguards police go introduce to prevent a repeat of dis kain incident?
- If di video no dey on social media, which kain tori police for tell di suspect family?










