You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Trump extend Israel-Lebanon ceasefire by three weeks but say e no go rush Iran deal
US President Donald Trump don announce say di Israel-Lebanon ceasefire don extend by three weeks.
For one post for Truth Social, e say e follow one meeting between Israeli and Lebanese officials for di Oval Office.
Israel and Lebanon first agree on 10-day ceasefire, wey start on 16 April.
After toks between di two countries envoys for Washington, President Trump announce say dem don extend am for anoda three weeks.
Di statement add say di truce na "gesture of goodwill" from Israel wey dem intend to use enable "good-faith negotiations towards a permanent security and peace agreement" between di two parties..
Trump say di Lebanese President Joseph Aoun and Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu go come White House for di coming weeks as US dey try broker longer lasting peace deal.
"Dem get Hezbollah to tink about," e tok. "We go dey work wit Lebanon to arrange tins well for dat country," e tok. "I tink e go be wonderful tin to settle dis togeda wit wetin we dey do for Iran."
Di two kontris no get diplomatic relations, and bifor dis month toks, di last direct, high-level discussions between dem hapun for 1993.
End of Di one wey oda users dey read well well
As e dey tok from di Oval Office, Vice-President JD Vance say di three-week extension of di Lebanon-Israel ceasefire na "major, historic moment".
Di negotiations between di two countries, wey start wit first round earlier dis month for White House, na dia first direct toks wit each oda since 1993.
"Of course, e for no hapun wit out di president direct engagement," Vance tok.
Top negotiators from each kontri show appreciation for di ceasefire extension as dem dey tok alongside Trump, Vance, and Rubio for di Oval Office.
Lebanese Ambassador to di US Nada Hamadeh Moawad, Israeli Ambassador to di US Yechiel Leiter, US Ambassador to Lebanon Michel Issa, and US Ambassador to Israel Mike Huckabee each praise Trump for im role for di negotiations.
"Mr President, under your leadership, Iran don dey so weak, di possibility to weaken Hezbollah and free Lebanon from dia occupation real," Leiter tok, as e add say Israel and Lebanon unite for dia aim to remove Lebanon from "dis bad influence wey dem call Hezbollah".
Huckabee compare Hezbollah to one pikin wey dey throw stone break evribodi window for one neighbourhood. Once dem fit stop di pikin, e tok, den di rest of di neighbours, like Lebanon and Israel, go fit live in peace.
Hezbollah and IDF accuse each oda of ceasefire violations
Di Israel Defence Forces (IDF) and Hezbollah accuse each oda of ceasefire violations.
Earlier, IDF say dem stop several projectiles wey dem launch from Lebanon, with siren sounding for Shtula area. Hezbollah tok for Telegram say dem target di area wit rocket attack.
For one statement for X, IDF add say dem kill three pipo wey dem identify as "Hezbollah terrorists" afta dem "no succeed" to launch missile towards Israeli Air Force aircraft.
E add say for two separate incidents, Hezbollah launch rockets towards IDF soldiers for southern Lebanon.
"Di actions na clear violation of di ceasefire agreement," dem tok.
On Thursday evening, Hezbollah say dem fire rockets at northern Israel in response to Israeli "violation of di ceasefire".
Di Lebanese state-run National News Agency dey report say Israel carry out strikes for Tyre for di south of di kontri dis morning.
Trump say e wan make di best deal wit Iran
President Trump say nobodi dey pressure am to end di conflict and say e wan make di best deal wit Iran.
E tok say US get "total control" of di Strait of Hormuz and wen Iran make deal, di important shipping route go open, as e add say e no want Iran to make hundreds of millions of dollars from oil sales during di ceasefire.
"I no want make dem make $500 million per day until dem settle dis mata," e tok. "Na me keep am closed... If dem no want make deal, den I go finish [di war] militarily."
"I no wan rush mysef," e tok.