How Arsenal, Manchester City fit win 2025/2026 Premier League

Man City Haaland dey in action

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pep Guardiola say "e no dey for our hands now" afta di 3-3 Everton draw
    • Author, Komla Adom
    • Role, Senior Journalist, BBC Pidgin
    • Reporting from, Accra
  • Read am in 6 mins

Di final stretch for di English Premier League don dey heat well well.

Both Arsenal and Manchester City dey battle each oda for di title wey Pep Guardiola tok say e no dey ova yet afta dem manage a late draw wit Everton on Monday.

Bifor di Monday game between Everton and City, Arsenal bin lead di table wit six points – City get one game for hand.

But afta fulltime, na Manchester City bin drop two points as dem come from 3-1 down to equalise 3-3 for di last minute – Jeremy Doku get two goals for dat game togeda wit Haalaand wey grab one goal.

Thierno Barry also grab two goals for Everton wey Jake O'Btien score di oda goal for di Toffees.

Afta di game, Pep Guardiola tok say "di title race no dey our hands anymore, bifor e bin dey our hands but now e no dey our hands."

"We get four games to play, we go see wetin go hapun," Guardiola tok.

Arsenal midfielder Declan Rice bin also tok say, "e no dey ova" afta dem lose 2-1 to Manchester City for 19 April.

True true, di way tins dey now go mean say e neva ova.

Wit di way tins dey show now, Arsenal dey lead di league table wit 76 points wit three more games against Westham, Burnley and Crystal Palace.

Manchester City get 71 points wit four games more – Brentford, Crystal Palace, Bournemouth and Aston Villa.

Everton and Man City players in action for di Monday night game

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Sabi pipo say Manchester City get tough games for di final stretch pass Arsenal

Sabi pipo tip Arsenal to get ova di line to win

Sabi pipo bin tok say wit di games wey remain, Arsenal get di advantage.

Sports sabi pesin Gary Al-Smith say, "di title dey for Arsenal hand now, dem go be champions if dem win all dia last three games for London."

Nathan Quao wey be sports news editor for Sporty FM tell BBC News Pidgin say, "Manchester City bin get tricky games compared to di last three Arsenal games and wen you see wetin hapun for di Everton game, anytin fit go wrong for city."

Im add say "city gatz dey alert against Brentford wey don pick points for di Etihad for recent times, Bournemouth be anoda tricky game sake of dem also wan qualify for Europe wey dem get form for dia home well well."

City wey go play wit Aston Villa for dia last game of di season gatz dey careful sake of Villa go also wan end di season for di top half of di table.

Oga Nathan Quao add say "if you look at City dia games and compare to di ones Arsenal go play (Westham, Burnley and Crystal Palace), Manchester City bin get di tricky games pass, but if dem wan give diaserf chance, dem get to win all dia games and hope di oda teams wey go face Arsenal go do dem favour."

Tins don set for di final showdown for di league season.

Whoever go slip from dis point gatz forget about di trophy.

So how soon Arsenal go fit win di title from now?

Remember say di Gunners neva win di Premier League for 22 years now.

For di last three seasons, Mikel Arteta carry di team finish second wey dem lose out on di title to Manchester City – in fact for di history of di league Arsenal be di club wey finish second place more dan all di odas (nine times).

Manchester United finish second seven times, Liverpool be dey second five times and Chelsea bin finish second, four times.

Arsenal fit win di title as early as Wednesday 13 May when Manchester City play wit Crystal Palace.

But dis go dey possible only if City first lose for Brentford on Saturday wey Arsenal gatz win for West Ham di next day.

If e hapun dis way – City go dey eight points behind Arsenal ahead of City dia next game wit Crystal Palace on 13 May.

Now if City draw or lose di Palace match, dem go dey seven or eight points behind Arsenal wit two games to go – wit dat, di result of Arsenal dia last two games wit Burnley and Crystal Palace for di last match day of di season no go dey important sef.

In case Arsenal bin play draw sef wit Westham on Sunday 10 May, dem still fit win di league for di last match day wit goal difference.

Di Premier League trophy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Arsenal no win di Premier League for 22 years

How Manchester City still fit technically win di league

Pep Guardiola and Manchester City go still fit win di league if dem win dia last four games wey Arsenal lose one of dia last three games, "sabi pesin Nathan Quao explain.

Dem go also win if Arsenal play two draws for dia last three games.

But e neva be straightforward mata - as di remaining fixtures also gat dia own permutation and teams wey don dey chase survival or place for Europe.

Whichever way e go end, Manchester City go look dis 3-3 Everton draw game and remember say na di game wey give Arsenal di advantage or di moment Jeremy Doku im last-minute goal grab one point against Everton wen dem bin dey lose dat game bifor.

Who go win if both teams finish wit di same points?

Now both teams fit still also end di season wit di same number of points.

Oga Quao tell BBC News Pidgin say, "if Arsenal draw one of dia last three games, wey City win all dia four games, both teams now go end wit 83 points."

If dis hapun for di last match day, di League rules give di following criteria wey dem go use to crown di winner for di league.

"Dem go first use goal difference – wey be di number of goals wey di team score minus di number of goals dem concede."

Goal difference – at di moment Arsenal (+41) get beta goal difference pass City (+37), by di end of di season if di goal difference too be di same for di two clubs, di next tin dem go take find winner na pesin wey score more goals

Goals scored – Nathan Quao tell BBC Pidgin say Arsenal don score 67 goals wey dem swallow 26, City get 69 goals wey dem collect 32. Dis go change by di end of di season but if both teams still get di same goals score di next tin dem go use na head-to-head

Points for head-to-head games - If di clubs finish level on points, goal difference and goals scored, Man City go win di title for head-to-head points. Dis na sake of dem bin get four points against Arsenal dis season, one win and one draw.

Away goals scored for head-to-head games – Guardiola im team bin sama Arsenal 2-1 for di Etihad stadium for 19 April wia dem play 1-1 draw for Emirates, wey mean say "both teams score one away goal wey don cancel each oda, so dem no fit get winner from dis stage unless dem enta play-off game."

Fans dey para for di final lap

Foto of some football fans

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Fans dey troll each oda wey some believe say Arsenal fit bottle di league again

Arsenal fans go hope say dis be dia year to finally win di title afta dem finish second for di last three seasons.

Mikel Arteta im team be di most consistent team for di league dis season, but if dem loose guard wey City overtake dem to win dis league at dis stage, di fans go vex for Arteta well well.

Some fans dey fear say dia team still fit bottle am at dis point, odas say dem get believe say Arteta go carry di boys cross di line.

Robert Kuegbesika wey be Arsenal fan tell BBC News Pidgin say, "di trophy dey our hands now to win wit di City result."

"E go hapun dis time, wey we go do party."

If dem manage to win di league, e go mean say at least dem get one silverware for di season.

For Manchester City fans, some believe say di Everton draw don scata dia chance to overtake Arsenal to win di title.

Odas still believe say Arsenal go drop points for dia last three games.

"I sabi say dis Everton game go be difficult for us, but we make lucky say we no lose dat game, so we still get slim chance if you ask me," Denis Kwakye wey be Manchester City fan tell BBC News Pidgin.

"Our last three games be tough but I trust Pep, im fit do wonders, we don do am bifor so make we no give up now," Denis Kwakye add.

Whichever way e go end, fans go remember dis season as di one wey serve plenty drama wey go down to di wire bifor dem find di winner.

But afta dat, di banter go still continue for long time to come.