Bayern Munich 0-1 PSG Champions League semi-final live update

Read am in 7 mins

Second half

74' PSG goalkeeper Matvey Safonov no too deal wit Bayern corner well but im manage to deal wit am as dey ball co ot from im hand.

72' Khvicha Kvaratskhelia of PSG leg bin dey shake for di edge of di box, im find Desire Doue, wey fire shot go side-netting.

69' Alphonso Davies, wey just di pitch, cross di ball for Luis Diaz, wey force a save from Matvey Safonov. Di shot no too carry weight sha.

66' SUBSTITUTION! PSG bring in Bradley Barcola, goalscorer Ousmane Dembele, don comot.

64' PSG's Desire Doue is tackled by Josip Stanisic just as he's about to enter the box. The visitors are doing about 15% the amount of attacking as Bayern - and yet seem more threatening.

62' Second save for di PSG keeper, di ball no disturb am at all as Josip Stanisic leg bin no too balance for di ball, im effort from outside di box just roll comot.

59 'Brilliant play by PSG player Nuno Mendes, e run di ball out of defence but e later lose possession of di ball.

58' Di tempo of di match don calm down small but Bayern neva dey luckey wit di chances wey dem don get for dis match.

55' If Bayern wan get any chance to enta final dem really need to step up sake of say PSG just dey press dem wetin no good for goal area.

52' Harry Kane neva get beta chance today. Any chance im get defender go block am inside di box and dem go block im shot too.

51' Harry Kane cut thru di top of im head wit im boot, Konrad Laimer land im face for ground wit im elbow.

49' Referee stop di game sake of head injury wey PSG defender Willian Pacho get but game don continue.

46' Second half don start

First half

Bayern Munich 0-1 PSG (4-6 aggregate)

45 +2 Half-time

45' Referee add two minutes.

41' Luis Diaz try too many tricks to pass Marquinhos and di ball comot from im leg.

38' Dis match dey hot well-well PSG dey press Bayern but Bayern sef no gree for dem.

34' PSG almost make di goals two. One free-kick land for Joao Neves head towards di bottom corner, Manuel Neuer tip di ball comot. Fine save.

33' YELLOW CARD! Bayern defender Josip Stanisic collect yellow card as e foul Desire Doue.

32' Referee say NO PENALTY!

31' POSSIBLE PENALTY! Anoda handball bin hapun as Vitinha clear di ball against im own team-mate Joao Neves' hand. E fit be Bayern penalty?

27' Nuno Mendes of PSG run jam Dayot Upamecano, im kon fall for ground but im don stand up.

23' Dem raise flag for Harry Kane for offside as dem stop play.

16' But bifor di physios come on, PSG winger Khvicha Kvaratskhelia bin run most of di length of the pitch to win anoda corner.

15' Right-back Warren Zaire-Emery lose di ball to Luis Diaz, but Michael Olise get di ball but dem block di shot. Jamal Musiala fall down wit injury but di physios enta field dey treat am.

13' Bayern player Michael Olise, bin tink say im don win corner kick sake of of Nuno Mendes but di officials say goal-kick.

12' Bayern striker Harry Kane fire shot but PSG defence block am from di edge of di box.

9' Free-kick for Bayern Munich Michael Olise play am but di ball curl den cross go wide for di far post.

5' Ousmane Dembele don score seven goals for di Champions League dis season - including five for im last three. Six assists for Khvicha Kvaratskhelia, more dan anybody else dis season.

3' Khvicha Kvaratskhelia of PSG run wit di ball from di midfield towards di goal area for di left corner left, im take advantage of di high Bayern defensive line. Im cut di ball as e pass am give Ousmane Dembele to lash di ball high inside di net.

3' GOALLLLLLL for PSG! Dembele score di first goal for dis match

2' PSG take di first kick and dem hold di ball bifor Bayern get chance touch am small.

1' Referee don blow whistle match don start.

Line up

Bayern: Neuer; Stanišić, Upamecano, Tah, Laimer; Kimmich, Pavlović; Olise, Musiala, Luis Díaz; Kane

Paris: Safonov; Zaïre-Emery, Marquinhos, Pacho, Nuno Mendes; Vitinha; João Neves, Fabián Ruiz; Doué, Dembélé, Kvaratskhelia

As Arsenal beat Atletico Madrid to reach dia first Uefa Champions League final for 20 years, fans go turn dia focus to Germany.

Bayern Munich dey host defending champions PSG for di Allianz Arena.

Di winner go jam wit Arsenal for di Champions League final wit Arsenal for Budapest.

Dis dey happun one week afta di two teams jam each oda wey end 5-4 for PSG for dia home for Paris.

Football fans and oda sabi pipo say di first leg of di fixture na di "final bifor di final" sake of say di game sweet well well.

Both teams bin show dia attacking power for dat game - later for Wednesday dem go get anoda chance to see who go enta di final wit Arsenal.

PSG comot Liverpool to reach dis semi-finals wey Bayern Munich comot Real Madrid.

To reach dia second straight final, PSG gatz beat Bayern Munich for dia home - team wey don dey give dem wahala for di last few seasons.

For di Bavarians also, dem for win by two or more goals to qualify for di final afta dem already win dia domestic title.

Unlike di Arsenal vs Atletico game wey no offer any fine football, fans dey expect say dis one go give dem value for dia moni and time.

Wetin di two coaches tok

Afta di end of di first leg, PSG coach Luis Enrique say im neva dey involved for game like dat bifor - game wey produce nine goals.

But im sabi say di second leg for Germany go dey different from di one dem play for Paris.

"Di magic of di Champions league don dey give di players special energy," Enrique tok.

Im add say "evribodi wan dey dia and make di most of di game, all di players apart from Quentin Ndjantoo dey available".

PSG winger Khvicha Kvaratskhelia wey score two goals for di first leg for Paris, dey expect ogbonge game.

"For di league phase, we no play well against Bayern - I bin dey remember dat game well well, we also get plenty injuries at dat time."

"But for di second half of di first leg for Paris, we play beta wey we show wetin we fit do. We show say we dey capable to beat dem only say we no score di goals we suppose score dat day," Khvicha Kvaratskhelia explain.

Bayern coach Vincent Kompany also dey ginger imsef for dis game.

"We already bin beat Real Madrid wey we don sama PSG also for Paris for di group phase, but dem still be defending champions".

Kompany add say "If any team dey dis world wey fit take dis challenge against PSG, ibi we [Bayern]. We sabi how good dem be, but we want win dis game".

Bayern Defender Dayot Upamecano wey also score one of di four goals for Bayern last week, dey focused.

"Na big match for us. We dey focus for our own game. We wan win di game."

Upamecano also add say "PSG get great players and super squad but we don dey focus for our own team wey we wan win di game".

Team news update

Bayern striker Harry Kane be di top-scorer for di Champions League dis season wit 13 goals, three more dan PSG forward Khvicha Kvaratskhelia (10).

Kane go hope to score more to lead di team to di final.

Coach Kompany gat almost all di full squad ready for dis game.

Raphael Guerreiro train wit di team afta im return from hamstring injury, na so Lennart Karl also return from injury.

Na only Serge Gnabry wey no dey available sake of im long term injury wey dey rule am out of di World Cup.

For di defending champions, na only captain Achraf Hakimi wey go miss sake of injury.

All di oda key players like Dembele, Neves, Doue, Vitinha and Kvaratskhelia dey available.