Who be Murtala Sule Garo wey Kano govnor nominate as im new deputy?

Wia dis foto come from, Murtala Sule Garo/Facebook
- Author, Abubakar Maccido
- Read am in 3 mins
Abba Yusuf, govnor of Kano, don send di name of Murtala Sule Garo go di state House of assembly make dem screen and confirm am as deputy govnor.
Inside one statement wey Mustapha Muhammad, im chief press secretary sign on Tuesday, Yusuf tok say “di nomination follow Section 191(3) of di 1999 Constitution (as amended), wey give di govnor power to nominate Deputy Govnor wen vacancy dey”.
“Afta wide consultation wit key stakeholders, di govnor don ask di Assembly make dem give di necessary approval for Garo nomination,” di statement tok.
Kano State don spend almost one month wit out deputy govnor.
Dis one come afta di resignation of di former Deputy govnor, Comrade Abdussalam Gwarzo, wey happun on 27 March 2026.
Some pipo believe say di resignation of di former deputy govnor get connection wit im refusal to follow Kano State govnor Abba Kabir Yusuf wen e change im party from NNPP to APC.
Gwarzo fall out wit Yusuf after he comot from New Nigerian Peoples Party (NNPP) go All Progressives Congress (APC).
Di former deputy govnor bin come under pressure to join di governor but e no gree.
Afta dat, di State House of Assembly begin impeachment proceedings against am.
Gwarzo submit im resignation during the crisis, den e comot from NNPP but go African Democratic Congress (ADC).
According to some reports, di former deputy govnor na one of di followers of Rabi’u Musa Kwankwaso, wey be di leader of NNPP for Kano and Nigeria as a whole.
Di movement of Abba Kabir Yusuf to APC cause serious controversy for Kano State, as many pipo say e betray im political godfather Kwankwaso wey help am becom govnor during di 2023 general election.
However, e no tey afta Abba Kabir Yusuf move to APC, Kwankwaso imself move to di African Democratic Congress (ADC), wey dey prepare to challenge di ruling party for di 2027 general elections.
Who be Murtala Sule Garo?

Wia dis foto come from, Murtala Sule Garo/ Facebook
Dem born Alhaji Murtala Sule Garo for 1978. E come from Garo town for Kabo Local Govment Area of Kano.
Dem describe Garo as a seasoned political administrator wey get over two decades of experience for both elective and appointed positions.
E don serve as State Organising Secretary of im party, Special Adviser to Kano State Govnor and elected Kabo Local Govment Chairman.
E also serve as Chairman of ALGON Kano, Commissioner for Local Govment and Chieftaincy Affairs, and Deputy Governorship Candidate of APC for di 2023 general elections.
Murtala Sule Garo marry Walida Atiku Abubakar, daughter of former Nigerian Vice President Atiku Abubakar. Di couple celebrate dia 10th wedding anniversary for November 2025.






