Taiwo Oyedele in as finance minister, Wale Edun out as Tinubu do minor cabinet reshuffle

Taiwo Oyedele and Wale Edun

Wia dis foto come from, Federal Ministry of Finance/X

Read am in 3 mins

President Bola Tinubu don remove Wale Edun, Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy and di Minister of Housing and Urban Development Umar Dangiwa for inside one minor cabinet reshuffle.

Secretary to di Govment of di Federation, Senator George Akume announce dis development for inside one memo on Tuesday, 21 April.

One statement wey di tok-tok pesin to di Secretary of di Govment of di Federation Yomi Odunuga issue say both Edun and Dangiwa don dey directed to hand ova to dia successors.

Taiwo Oyedele, wey previously dey serve as Minister of State for Finance, go take ova from Edun as Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy.

Di memo name Muttaqha Rabe Darma as di ministerial nominee and minister designate to take ova from Dangiwa for di Ministry of Housing and Urban Development.

Di memo also direct Dangiwa to hand ova to di Minister of State for di ministry.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

According to di memo, "all handing ova and taking ova processes gatz dey completed on or bifor close of business on Thursday 23rd April, 2026."

Although, clear reason neva dey for dia removal, however, explaining di President decision, di secretary of di Govment of di Federation tok say di changes na to strengthen cohesion, synergy in governance plus to achieve more impactful delivery on di economy to Nigerians, through di Renewed Hope Agenda.

E add say di President exercise im powers under Sections 147 and 148 of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria (1999, as amended) in approving di reshuffle.

Di President tank di outgoing ministers for dia services to di nation and wish dem best for dia future endeavours.

Na for March President Tinubu bin nominate Taiwo Oyedele wey bin serve as chairman of di Presidential Fiscal Policy and Tax Reforms Committee as minister of State for Finance.

E bin replace di former minister of State for Finance, Dr Doris Uzoka-Anite wey di President move go anoda ministry.

Profile of Taiwo Oyedele

Oyedele na 50 years old from Ikaram-Akoko, Ondo State, southwest Nigeria.

For im career, e be economist, accountant and public policy expert.

Oga Oyedele bin attend Yaba College of Technology, wia e get im Higher National Diploma (HND) for accountancy and finance.

E later go Oxford Brookes University wia e earn BSc for Applied Accounting.

Oyedele complete im executive education programmes for di London School of Economics, Yale University, di Gordon Institute of Business Science, and di Harvard Kennedy School.

Oga Oyedele don spend 22 years of im working career for PwC, afta e join dem for 2001 and rise to become di Fiscal Policy Partner and Africa Tax Leader.

Oyedele na professor for Babcock University wey dey Ogun State and also visiting scholar for di Lagos Business School.

E don appear for different conferences and summits wia e address tax matters.