APC 100 million naira presidential nomination form and wetin oda parties dey do ahead of 2027 election

From L-R: Senate President Godswill Akpabio, APC National Chairman Nentawe Yilwatda, President Bola Tinubu, Vice President Kashim Shettima

Wia dis foto come from, APCNigeria/X

Read am in 5 mins

Di general election fever don dey enta small small for Nigeria as political parties start to announce dates for dia primary election.

According to di election timetable wey di Independent National Electoral Commission (Inec) bin release, di period for parties to conclude dia primary elections na betwin April 23 to May 30, 2026.

Di ruling All Progressives Congress don roll out dia own party timetable and e show say dia presidential primary election go hold on May 15, 2026, and di price for di forms na 30 million naira for di expression of interest form and 70 million naira for di nomination form, wey make am total of100 million naira.

As tins be now for di APC, no oda pesin don show interest to follow President Bola Tinubu drag di presidential ticket, so e dey almost certain say e fit get di ticket unopposed.

Also, according to di APC timetable, di sale of forms for party members wey wan contest for office go start from 25 April reach 2 May, and di last day for submission of forms na 4 May 2026.

Primary election for oda aspirants apart from di office of di President go hold from 18 to 23 May, 2026.

Di prices for di forms na six million naira for aspirants for State House of Assembly, 10 million naira ($7,000) for pipo wey wan run for di Federal House of Representatives, 20 million naira for senatorial aspirants, and 50 million naira ($5,000) for di ones wey wan contest for govnor.

Dates for di primary elections for House of Reps na 18 May, Senate - 20 May, State House of Assembly - 21 May, and govnorship - 23 May, 2026.

Di party also give 50 percent discount for di price of nomination form to women and youth wey wan run for office, but dem go pay full amount for di expression of interest form.

APGA fix 75 million for presidential form

Similarly, di All Progressives Grand Alliance (Apga) don also release dia timetable for dia election, plus di price for nomination forms for members of dia party wey wan contest for di next general election.

According to. dis timetable wey di Apga national publicitty secretary Ejimofor Opara release, di price for di expression of interest form and di nomination form for pipo wey wan contest for di presidential seat na 25 million and 50 million naira respectively, to make am total of 75 million naira.

Howeva, Apga as a political party bin don announce say dem go adopt President Tinubu as dia presidential candidate for di 2027 election, so e neva dey clear weda anybody go still pick di presidential form from di party.

For govnorship position di total moni for di forms na 35 million naira; for senatorial seat na 21 million; 16 million for House of Reps seat, and eight million for State House of Assembly position.

Di date for Apga primary elections for all di aspirants, weda na govnorship, senatorial, House of Reps or State House of Assembly seats, na 23 May 2026.

Wetin dey happun for opposition parties

On di oda hand, di African Democratic Congress (ADC) wey be di joinbodi opposition movement for Nigeria, neva announce di date for dia own primary elections.

Di party still dey face plenty court wahala concerning who be dia true-true leader, and Inec don tok say dem no go recognise any of di two factions wey dey claim leadership until di court give judgement.

Howeva, di ADC faction led by former Senate President David Mark say dem no. go mind wetin Inec tok, and dem don continue to dey conduct dia activities like di national convention wey dem hold on 14 April 2026.

Also, di Peoples Democratic Party (PDP) neva also announce date for dia own primary election. In fact e neva even dey clear weda di PDP go present candidates for di 2027 elections.

Dis na also sake of plenty internal gbas-gbos and court mata to determine who be di authentic party leadership. Howeva, e be like say di PDP faction wey di current Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike dey lead, don gain di upper hand for di mata.

Dem don hold dia national conventin wia dem elect new national leaders for di PDP, and on Monday di new National Executive Committee bin meet for dia secretariat for Abuja, di first time dem dey use di venue since November 2025 wen di two groups bin clash wit each oda for dia, wey make police to seal di place.

Di Labour Party also neva fix date for dia primary election afta dem just manage to put dia own house in order.

Court case and internal wahala bin nearly tear di party apart, but di mata settle afta di federal high court for Abuja, for January dis year, declare Nenadi Usman as di true-true leader of di party.

Since den, di party don dey fix diasef togeda bicos many of dia top members bin comot during dat crisis, including dia former presidential candidate during di 2023 elections, Peter Obi.