Appeal court put spanner for ADC congress, party counter Nafiu Bala list for 'Inec portal'

Published
Read am in 4 mins

Di Action Democratic Congress (ADC ) don enta anoda kasala afta Court of Appeal for Abuja don uphold di judgment wey dey restrain di Independent National Electoral Commission (Inec) make dem no recognising or participate for any state congress wey any committee wey Senator David Mark appoint, organise.

Senator David Mark bin appoint caretaker leadership of di African Democratic Congress (ADC).

Na for di split decision of two-to-one, wey di Court of Appeal on Monday for Abuja affirm di judgment.

Di three-member panel of di Appeal court, for di lead judgement wey Justice Okon Abang deliver, tok say dem no see any reason to set aside di restraining order wey di Federal High Court for Abuja bin give against di ADC wey David Mark dey lead on April 29.

Dem also uphold di order of trial Justice Joyce Abdulmalik, wey bin restrain di Mark-led executives from interfering wit di tenure and functions of di elected state executives of di party.

Di appeal court agree say di responsibility for conducting state congresses of political parties dey for di hands of di elected state executive committees, not wit di national leadership.

Di African Democratic Congress (ADC) say tori wey dey fly upandan say one group of ADC don upload names of presidential candidate and oda nominees for di Independent National Electoral Commission (Inec) portal no be true.

For one post wey di ADC post for dia verified social media page, dem allege say dem deny say Nafiu Bala Gombe upload names of presidential candidate and oda nominees to di Inec nomination portal.

"Di claim na blatant lie. And e dey quite easy to verify why." ADC tok for post.

Di political party wey dey face different electoral kasala as one of di main opposition parties for Nigeria, make am clear say "Inec no dey issue nomination portal access or nomination codes to any leadership wey no dey recognise.

Secondly, di Commission no go issue two codes to di same party."

Dis clarification dey come as some pipo dey spread tori say Inec give one faction of ADC code to upload details of dia candidates for di Inec portal ahead of di 2027 general elections.

ADC say if na so e dey easy evri impostor for dey upload names to di portal and proclaim say dem be di authentic leadership of a political party and no be so di law or di Commission and dia processes dey work.

"Where di evidence of dis purported upload by one group of individuals wey di law or di electoral body no sabi, dey?Dem say dem dey formally draw di attention of di Independent National Electoral Commission (Inec) to wetin resemble forgery and unauthorised use of documents wey dey claim say e come from di Commission.

ADC add say tori like dis fit cause kasala and fit undermine public confidence and integrity and reputation of Nigeria.

Dem tell Inec to investigate dis mata and make dem take di necessary steps to correct dis tin wey fit cause confusion.

Di Action Democratic Congress don dey make headlines since dem bin announce Senator David Mark as di Chairman of di coalition.

One faction wey Nafiu Bala Gombe dey lead bin drag di APC go court. Di mata waka sotay e reach di Supreme Court of Nigeria.

Di court wey tell di party to maintain status quo, send di mata back to di Federal High Court.

Federal High Court later adjourn hearing of di mata indefinitely.

ADC still dey find wey to settle dat one, wen anoda court give order say make Inec remove ADC and some oda political party dia names from register.

Di group wey drag di parties go court say ADC and di oda parties no meet di constitutional requirement to still dey registered as political party.

E neva dey clear weda ADC go be one of di political partties wey go field candidates to contest for di 2027 elections wit all dis wahala wey dem dey face.

However, ADC successfully conduct dia primaries across di kontri within Inec time frame.

Na to upload details of candidates wey go represent di party for di 2027 elections na im remain.

Inec neva officially comment on dis mata as e dey hot , however local media Punch Newspaper report say one senior official for di commission tell dem say Nafiu Bala Gombe no get access to dia portal and notin like dat happun.