Adeleke sue EFCC for 2 billion naira afta Tinubu order anti-graft agency to comot hand from Osun account - wetin Peter Obi, Makinde dey tok

Wia dis foto come from, Ademola Adeleke/X, EFCC/X
Osun state govnor Ademola Adeleke don sue Economic Financial Crimes Commission (EFCC) for 2 billion naira sake of how dem freeze di bank account of di Osun state govment few days to di state govnorship election.
Earlier on Wednesday, di govnor bin announce say di EFCC don freeze di state account and call out di chairman of di anti graft agency to explain why e freeze di account.
E bin promise to challenge di mata for court.
Dis court case dey come afta president Tinubu order di anti-graft agency to comot hand from Osun account.
President Bola Tinubu on Thursday direct di Economic Financial Crimes Commission (EFCC) to vacate di court order dem get to freeze Osun state govment account.
For one statement wey e personally issue on Thursday, Tinubu say im feel "deeply embarrassed no be bicos EFCC exercise dia mandate wey dey backed by a court order, but by di timing of di agency action".
Tinubu reaction dey come afta EFCC freeze di account of Osun state govment few days to di govnorship election, on top accuse of fraud wey relate to di tune of eleven billion naira 11 billion naira ($8 million).
E order say make di commission stop whatever action dem get against di state govment.
Di Nigerian leader add say since e enta office, im don consistently maintain say anti-corruption and law enforcement agencies must dey allowed to discharge dia statutory responsibilities independently, professionally, without fear or favour, or political interference.
Sake of dat im deliberately no dey chook mouth for dia operational activities.
Di president condemn di timing of di EFCC action as e say di time wey e happun go make pipo feel say di federal govment dey interfere wit di election.
"While I neva get full informate on di facts wey inform di action of EFCC wey make dem approach di court to obtain di said order wey freeze di Osun state govment account, I no get doubt say di timing of di action of EFCC dey inauspicious, and therefore I feel compelled to intervene."
Di Nigerian leader add say since e enta office, im don consistently maintain say anti-corruption and law enforcement agencies must dey allowed to discharge dia statutory responsibilities independently, professionally, without fear or favour, or political interference.
E say sake of dat im deliberately no dey chook mouth for dia operational activities.
Wetin Peter Obi and Govnor Makinde tok about di matter
Former govnor of Anambra state Peter Obi release state say di timing of di freezing order dey suspicious as e happen for period wen election wan happen.
E say e no dey against fight against corruption but say make dem use due process to do am. Say dis action dey like dem wan use am as tool towards di upcoming election.
E add say dia is growing perception say anti graft agency’s don dey turn to tools for di hands of politician, say dis na democracy and nobody suppose suppress am.
Di presidential candidate of di NDC for Nigeria 2027 general election say if evidence of wrongdoing dey, di Constitution provide clear path: make dem seek di appropriate orders from competent court. No agency suppode exercise powers beyond di ones wey law grant.
“I dey call on all relevant authorities to act strictly within di Constitution and ensure say nothing dey undermine di credibility of Osun tGovernorship Election” na so e tokt.
Govnor of Oyo State Seyi Makinde for him comments on X condemn di use of federal institutions to disrupt governance in opposition states in Nigeria.
E say no government dey above scrutiny but wen dem use institutions like di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) to witch hunt specific states or public office holders, e dey indicate say dia investigations dey selective and dey comot public trust in di institutions.
”Di "freezing" of official state govment account without due legal process pass di powers wey law give EFCC, di timing of di action suggests say na just anoda attempt by di federal govment to unduly influence di forthcoming govnorship election for Osun State” na so e tok.
E say make federal institution do di work law permit dem to do and make di rule of law prevail over di rule of politics.
'Why we freeze Osun state govment account' - EFCC
Di kontri corruption police for inside one statement on Wednesday night say dem don dey torchlight di state govment since March on top accuse of fraud wey relate to di tune of eleven billion naira eight million dollars.
"Di commission dey busy investigate di Osun state govment since March, 2026, on top di alleged magomago way dem take handle Ecology Funds, Intervention Funds and Federal Account Allocation Committee, FAAC account wey amount to di tune of N11, 000,000, 000.
Dem add say some of di state govment officials, especially di Accountant General of di State, don get interview sessions wit dia investigators.
Di commission say dem for no freeze di account, but dem notice say pipo dey withdraw big-big money comot di account into different corporate entities and dat na why dem quickly block di accounts, so dat dem no go fit move dos kain heavy funds again.
"These ongoing investigations of di state govment for no warrant any placement of Post No Debit order on dia account but na sake of di way dem dey move money from di accounts go different suspicious accounts since 2 August.
EFCC make am very clear say na within dia right to safeguard public money, assets and resources.
Dem say dem no fit siddon dey look and watch as pipo dey milk di state govment account.
EFCC also say even though dem no say govnorship election wan hold for di state, na dia responsibility to save di state money.
"While di Commission dey fully aware of of di upcoming govnorship election for Osun State, dem get responsibility to act in defence of di sanctity of di funds of di state. E no go dey nice for di Commission to use di excuse of di election to fold dia hands and not perform dia legally assigned functions."
Earlier, di commission bin direct say make nobody withdraw any money from di Osun state govment statutory allocation account as part of one ongoing investigation, according to reports.
For inside one letter dated August 5, 2026, wey Punch News quote, di Assistant Commander of EFCC, Adenike Babalola sign for di Director of Investigation, e instruct di bank to put a post-no-debit restriction on di account pending di conclusion of di investigation.
Dem address di letter referenced 000/EFCC/ABJ/HQ/PFS/TA/OSUN/VOL.17/666, to di Managing Director of First Bank, wit attention to di Chief Compliance Officer.
Dem identify di affected account as "Osun State Government Statutory Allocation".
Di commission say di directive bin follow one earlier correspondence wey di date na April 15, 2026.
Dem add say dem make di request in pursuant to Section 38(1) and (2) of di Economic and Financial Crimes Commission (Establishment) Act, 2004, and Section 24 of di Money Laundering (Prevention and Prohibition) Act, 2022.
"Refer to our letter CR:3000/EFCC/ABJ/HQ/PFS/TA/OSUN/VOL.17/165 dated 15th April 2026 on di above subject.
"In furtherance to di above, we kindly request say make you place a Post-No-Debit on di account. Dis request is made pursuant to Section 38 (1) & (2) of di Economic and Financial Crimes Commission (Establishment) Act, 2004 and Section 24 of di Money Laundering (Prevention and Prohibition) Act, 2022," di letter read.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
'We dey go court' - Govnor Adeleke
Osun state govment don start legal action against di Economic Financial Crimes Commission (EFCC).
Dis dey come afta di kontri corruption police freeze di state govment bank accounts few days to di state govnorship election.
Di state govnor Ademola Adeleke wey confam di development for statement explain say na on Wednesday morning dem receive letter from dia banker, and e forward to dem letter from di EFCC.
For di letter, EFCC order di bank to freeze di Osun state govment account, govnor Adeleke claim.
Adeleke for im reaction to why EFCC block di state govment account, kwesion di legality of action.
E ask di EFCC chairman Ola Olukoyede to explain give di state and Nigerians why di commission freeze di state govment account, and make e show proof of why e do am.
"All I ask na for di EFCC chairman to explain to di good pipo of Osun State and to Nigerians in general, why dem freeze Osun State Government Account, and show proof to support whatever reason, e present," govnor Adeleke tok.
E also say im don instruct im Attorney General to challenge di illegality for di federal high court Osogbo, for Osun state, southwest Nigeria.
Meanwhile, Osun State Attorney General and Commissioner for Justice, Oluwole Jimi-Bada on Wednesday, tok say im don receive order from di govnor to sue di anti- graft agency for freezing di govment accounts.
Jimi-Bada wey tok say dem ready to go court, say di kontri corruption police move fit affect govment business, as e clear am say di govnor no dey use state money fund im campaign for re-election.
However, prior to dis development, political tensions bin dey ground for di state as di govnor on several occasions don raise alarm ova attacks, intimidation and harassment of Osun state pipo, by di opposition All Progressive Congress (APC) for di state.
Recently, di govnor wey dey under Accord party bin call on Nigeria President Bola Tinubu to intervene for di political crisis wey dey happun for di state.
"Di loss of innocent lives for Osun gatz stop. All we dey ask for na simply free and fair election."
Freezing of di state govment account na di latest for di series of battles wey dey confront di southwest state ahead of di govnorship election wey go hold on 15 August.
Di govnor for statement explain say in di last few months, di state don face plenty challenges, wey include, open gun attacks on di citizens, di deliberate paralysis of di local govment system, plus di daily harassment and arrests of Accord members.
E allege say police don arrest about 60 member of im party, Accord, and detain dem without any charges.
"You dey aware of constant police raids and arrest of Accord leaders for no reason and without any warrant of arrest. Dem don kill several Accord members, and dem don arrest and carry about 60 Accord members go Abuja and detain dem without any charges."
E point finger to di former state govnor Gboyega Oyetola - di current minister of Marine and Blue Economy as di pesin wey dey behind di crisis for di state. "All these intimidation and attacks wey dey happun na on di order of Gboyega Oyetola on top election wey im candidate no fit win."
Makinde, Obi, and odas react
Ogbonge politicians and stakeholders for Nigerian don react to di move by EFCC to block Osun state govment account for di eve of a govnorship election for di state.
Among di pipo wey chook mouth for di mata na Peter Obi, di presidential candidate for di NDC for di 2027 general election. E say although im dey always support fight corruption, however, di timing for dis one raise legitimate questions.
E also ask say since investigations don dey go on for months, why e be say na few days to di election, EFCC go take such action?
Oyo state govnor Seyi Makinde say "freezing" di official account of a state govment without due legal process pass di power of di EFCC.
E also say di timing of di action suggest say dis na anoda attempt by di federal govment to unduly influence di forthcoming govnorship election for Osun state.
"Di increasing use of federal institutions to disrupt governance for opposition states for Nigeria dey condemnable."
E add say no govment dey above scrutiny but wen dem dey use institutions like EFCC to witch hunt specific states or public office holders, e show say dia investigations dey selective and e erode public trust for these institutions.










