Nigeria Super Falcons beat Egypt 6-2 to progress to quarter-final of Wafcon

Wia dis foto come from, Reuters, EPA/Shutterstock
Nigeria Super Falcons bin face di Female Pharaohs of Egypt for one di toughest Group C matches but dem win 6-2 to qualify for di quarter-final.
Dis particular match for di ongoing Women African Cup of Nations (Wafcon) 2026 for Morocco, na big decider for Nigeria.
If to say di Falcons lose di match, dem go comot for di tournament and e for be huge blow to dia dream of participating for di 2027 Fifa Women World Cup.
Afta 90 minutes of ogbonge football wit goals from evri angles, Nigeria hope for di 2027 Fifa World Cup dey alive again.
Di Super Falcons enta di match witout defender Tosin Dimehin wey collect red card for dia last match and midfielder Jennifer Echegini wey also dey serve suspension sake of double yellow card for dia last two matches.
So far, Nigeria wey be di defending Champion get only 6 points from three matches. Dem lose 2-3 to Malawi for dia first match and beat Zambia 1-0 for dia second match.
Malawi dey lead di group wit six points. Zambia also get six points while Egypt don lose dia two matches so far, and now di third one.
As Zambia beat Malawi for dia Wednesday evening match and Nigeria beat Egypt, na im be say Malawi, Nigeria and Zambia get six points each for group C.
But dem kon look at di head-to-head records of di three teams to determine who go enta di next round.
Di two best teams for each group proceed to di quarter-final and from dia to di semi finals.
Di four semi finalists go automatically qualify for di 2027 Fifa Women's World Cup for Brazil.
Nigeria Super Falcons na ten times winners of di Women African Cup of Nations.
How Nigeria vs Egypt take waka
For di 10 minutes, Nigeria don begin dey set di pace early and begin dey take control of di pitch.
First goal for Nigeria na from Asisat Oshoala wen VAR check and award Nigeria penalty for handball afta Oshoala shot dey blocked.
Agba Baller step up hersef into di yard and she calmly send Egyptian goalkeeper di wrong way, as she place am into di right corner!
By di 45th minute, Nigeria secure anoda goal just bifor di half-time wen Toni Payne play from di short corner to Rinsola Babajide. Den Rinsola dance into di box and tip di ball give Gift Monday wey kon smash am into di back of di net.
For di 57th minute, anoda goal enta for di Super Falcons wen Rinsola Babajide set up substitute Uchenna Kanu. Kanu den fire left-footed strike straight past di Egyptian defense.
For di 80th minute, VAR intervene afta Uchenna Kanu fall inside di penalty box. Na Christy Ucheibe step up to di penalty spot and sweetly convert di penalty goal and put di game in high spirit.
Di Egyptian manage to put one goal back for di 84th minute, dat give dem small hope but di hope no too last.
Di 91st minutes show some dramatic move afta VAR call di referee to di monitor to check di challenge against Super Falcons player, but di penalty decision stand.
Rasheedat Ajibade take charge dis time, step up to di spot, and fire di shot inside di net.
By di 98th minute, Nigeria don get confidence to qualify to di next round as Joy Omewa get her first Wafcon gaol.
Gift Monday dribble di Egyptian defence bifor she find Rasheedat Ajibade, wey also dribble into di box and serve am to Joy Omewa to net her first Wafcon goal.
Na so Nigeria qualify for di quarter-final of di Wafcon games.
Bifor di game wey carry Nigeria reach di quarter-final, dem don only score three goals so far, di first na from Captain Ajibade via penalty, di second na from Uchenna Kanu while Asisat Oshoala score di third goal.
Egypt on di oda hand don play two matches and score only one goal for dia 3-1 loss to Malawi. Dem bin don chop 6-0 from Zambia during dia first match.










