Why Nigeria govment postpone evacuation of citizens from South Africa

Di Nigerian govment say dem don postpone dia plan of sending evacuation flight to South Africa to Wednesday, sake of logistical challenges according to wetin officials tok.
Di aircraft, wey bin dey expected to leave Johannesburg on Monday evening wit about 270 passengers, don dey delayed so authorities go finalise dia operational arrangements for di repatriation exercise.
Nigeria Ministry of Foreign Affairs tok-tok pesin, Kimiebi Imomotimi Ebienfa, explain say na sake of "unforeseen logistical considerations" na im make dem rescheduled di evacuation to Wednesday, 10 June.
So far, more dan 1,000 Nigerians don dey screened and cleared to return home from South Africa, according to di Nigeria in Diaspora Commission (Nidcom), as part of govment response to di rising anti-migrant wahala and riots wia South African citizens dey target foreign nationals for di kontri.
President Bola Tinubu don approve five evacuation flights in total as screening and registration of Nigerian citizens for South Africa don dey extended to Wednesday.
Di foreign affairs ministery say dem go announce more details about di time for departure and arrival for Lagos once dem get final clearance.
Wen similar kasala bin burst like dis for South Africa in 2019, na one Nigeria businessman, Allen Onyema bin send im aircraft to carry Nigerians come bak free of charge.
Howeva, di Foreign Affairs tok-tok pesin, Kimiebi Ebienfa, tell BBC News Pidgin for one press conference last month say di Nigeria govment no go wait for philantropists to donate dia planes dis time bifor dem go do wetin dem suppose do and evacuate dia citizens wey dey face trouble for any part of di world.
Meanwhile, di govment of Ghana say dem don bring back di second batch of dia citizens from South Africa, wey di number na about 350 pipo wey arrive for Accra over di weekend.
E bring di total number of Ghanaians wey don evacuate from South Africa to more dan 600, and more returnees dey expected in di coming weeks as part of ongoing repatriation programme sake of safety concerns.
Officials say all di returnees go pass through screening and dem go dey registered as dem arrival for Accra airport.
Di kontri Foreign Ministry say di evacuations dey funded tru contingency budget allocations, and dem also beg local businesses to support di reintegration of di returnees by offering dem employment opportunities.
Di ministry also tok say dem dey consider legal steps to ask for compensation for dia citizens wey allegedly lose dia property or wey dia businesses bin dey damaged during di recent riots for South Africa.
Similarly, di govment of Malawi, wey get border wit South Africa don also publish photos of dia citizens wey dem evacuate from di kontri following dia land border.
"150 Malawi nationals from South Africa undergo immigration formalities for di Beitbridge Border Post as dem make dia way bak home unda di govment voluntary repatriation exercise," di govment post for dia official Facebook page dis monday morning.

Wia dis foto come from, Malawi Governemnt/Facebook
Ramaphosa address nation ova protest against foreign nationals
All dis developments dey come as di President of South Africa Cyril Ramaphosa make a nationwide broadcast on Sunday to address di issue of illegal migration for di kontri.
"We must to end illegal migration, we must to deal wit di challenges. We reject di notion say we must to tolerate illegal migration. We fit enforce our laws, we fit secure our communities. We fit overcome di problem of illegal migration," Ramaphosa tok for dat broadcast.
Howeva, e add say make South Africans no turn against foreign nationals and against each oda, rather dem gatz "overcome di challenges tru peace and love, not tru fear, anger or violence".
Ramaphosa acknowledge say migration na global issue wey dey affect many kontris around di world, and even South Africa, like many oda kontris truout history na product of migration, "yet we must recognise say illegal immigration no be di cause of all our economic challenges".
Di ansa to some of di problems for South Africa, according to President Ramaphosa na faster economic growth, greater investment, industrial expansion, infrastructure development and creation of plenty new jobs.
Ramaphosa roll out some measures wey e say di kontri go take to address illegal migration into di kontri.
Di plan include to secure dia borders and address di loopholes wey undocumented migrants dey take advantage of, to crackdown on illegal workers and deport illegal migrants wey dey live for South Africa, and to target employers wey dey give work to illegal migrants and increase dia punishment wit jail term.
Oda measures na to strenghten di immigration system wit technology, extend biometrics for international airports and oda busy ports, and establish digital registration to make am hard to manipulate immigration processes.








