Nigerians dey debate Tyla Concert for Lagos afta South Africa Immigration wahala

Tyla as she dey perform for di opening ceeremony of di 2026 World Cup for Los ANgeles

Wia dis foto come from, Patrick T. Fallon / AFP via Getty Images

Published
Read am in 5 mins

South African pop star, Tyla don drop di dates for her A*Pop album world tour.

Dis na part of di promotion for di album, A*Pop wey drop on 24 July and as part of am include three dates for Africa.

She dey plan to perform for Lagos, Nigeria for 22 December, wey bi di middle of di Detty December period.

She announce dis one wen she list out di date for her tour for new social media post.

Dis go be di first headline concert wey Tyla dey run for di kontri even though she bin visit during Detty December for 2024 dey chill wit Rema, Ayra Starr and Tems.

Even though Lagos dey di list, na di only place, according to her tour site wey neva confam venue for wia e dey happun.

Tyla in come Lagos for 2024, and she even climb stage for impromptu performance but afta dat performance she bin promise say she go land di kontri to do her own heafdline show, o dis mata na two years e take cook to done.

But plenti Nigerians dey call for dis plan to catch fire as dem dey ask for kontri pipo make dem no attend di concert sake of di strained relationship between South Africa and most African kontris sake of di immigration palava for di kontri.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Plenti voices online don call out di move as tone deaf wey include media personality, Do2dtun wey call out in advance any pesin wey go for Tyla show.

E write for X (formerly Twitter) say "Na di audacity for me, People dey allowed to live freely but if you no dey accountable and you no fit read di room, you sef join inside di problem".

E no be di only one wey do call to make dem boycott dis concert.

Social commentator, Solomon Buchi don add im own voice to di call asking for boycott to be di protest for di xenophobia for South Africa.

E tok say, "Tyla dey do show for December for Nigeria and dat show must not happun... no be afta di xenophobic attacks wey we see for South African and how immigrants nad especially Nigerian migrants bin dey treated. We no hia pim from Tyla, not even performative activism."

Many oda pipo dey call out di fact say Ayra Starr bin suppose get show for South Africa earlier dis year but dem no give am visa to torchlight di need for di Nigerian goment to do-me-I-do-you and no give visa back to Tyla to even come Nigeria.

Howeva tori pipo report say, di mata actually happun for 2024 February and Ayra Starr still do her concert for Cape Town even afta di visa palava but wetin happun be say e come hold for October 2024.

Meanwhile former Nigerian Presidential Candidate, Omoyele Sowore, support Tyla decision to tour for Nigeria say make pipo no use Tyla to pay for di crimes of xenophobia.

E tok say, "make Nigerians direct dia anger give dia real enemies like dia criminal leaders like Tinubu wit di APC party wey don spoil our kontri sotay our pipo don reduce to second class citizens across Africa and di rest of di world plus di irresponsivle South African leaders like Cyril Ramaphosa wey im failure bin create di conditions for xenophobic kasala".

E add say, "Tyla Lagos Concert must go on".

But di mata even big pass just Tyla tour date, for June, di South African Minister of Justice bin tell tori pipo about wetin artistes dey tell am say dem dey cancel di concerts of South African artistes all ova di continet sake of di gbege wey dey happun for di kontri.

Even wit dis k-leg wey her concert dey get or di kurukere relationship between Nigeria and South Africa, Tyla don dey run tinz wit Nigerian artists along di span of her career.

Dis na starting for 2023, wen Ayra Starr bin feature for her single, Girl Next Door bifor she come join DJ SPINALL and OMAHLAY for dia single wey dem call One Call for 2024.

For dat same 2024, she bin feature Tems for her first studio album, Tyla + for di song, No. 1.

Di latest collabos wit Nigerian stars na for 2025 and Wizkid join her song Dynamite. She tok say she bin record di song wit am for 2022 but e just take time for di song to come out.

She also be part of di group of African artistes, like Wizkid and Burna Boy wey dey call for di global music industry to no box African artistes for inside di term Afrobeats.

Dis na she don win mulitble awards for di Afrobeats category and collect Grammy twice for Best Afrcan Music Performance for 2024 wen she do Water and 2026 for Push 2 Start.

Wetin be di entertainment effect wey di mata for South Africa don cause

Tyla sing South Africa anthem for World Cup

Wia dis foto come from, Torbjorn Tande/DeFodi Images/DeFodi via Getty Images

Wetin we call dis foto, Tyla sing South Africa anthem for World Cup

See even di World Cup enta di Whatsapp group of how African kontris seem to dey blacklist South Africa since di protests against immigration for di kontri.

Dis comot as many of di African fans wey go for di event bin openly dey support any team wey Bafana Bafana bin dey play against.

Also South Africa Minster of Justice and Constitutional Development, Mmamoloko Kubayi tok about how one artiste bin tell am say dem bin cancel all her shows across di continet.

In fact dis Tyla mata mirror wetin do Burna Boy for 2019.

Burna Boy bin call out di xenophobi attacks wey bin dey happun for South Africa for Speember of dat year as im declare say, im no go enta di kontri to perform till dem shape up.

Tori be say dis tweet start beef and di now late AKA.

No be only am bin tok for di mata as stars like Wizkid, Yemi ALade and Ycee even chook mouth inside di mata.

Howeva, for Novemberof dat same year, Burna Boy say e dey do African Unite Concert for Cape Town in which e promise to donate part of di money from di concert give victims of xenophobic attacks.

Pipo hala am wit some even saying im beef wit AKA ova xenophobia na im cause one Nigerian to kpai during di kasala.