Nigerian Army rescue 360 captives including women and children from Boko Haram

Two women wear purple wit oda children siddown for floor.

Wia dis foto come from, Screenshot from Nigerian Army

Published
Read am in 5 mins

Nigerian Army say dem don rescue 360 pipo wey Boko Haram jihadists kidnap for communities for north-eastern Borno state, Nigeria.

Di Army say dem work on intelligence report to take rescue di kidnapped pipo wey include men, women and children from di jihadists.

According to di Army, di captives na from around Ngoshe, community wey be mainly Muslim dominated near di border wit Cameroon.

Rememba say three months ago, police for Nigeria don confam to di BBC say jaguda pipo attack Ngoshe community for Borno State, northeastern Nigeria wia dem kill and abduct pipo but dem no confam di exact number of casualties.

Dat time, local media report say di suspected militants bin abduct more dan 100 women and children during di attack.

For early March 2026, Ngoshe community come under attack from Boko Haram fighters wen pipo dey break dia Ramadan fast.

According to di military tok tok pesin, Lt-Col Haruna M Sani, e describe di assault on Boko Haram as one of di military "most significant hostage rescue operations" for di north-east.

Di Army narrate how dem carry out di operation wey lead to di rescue of di abducted pipo from wia di Boko Haram hold dem for Mandara Mountains area of southern Borno State.

For di videos wey Nigeria Army post for dia X page, e show wia plenty of di rescued victims siddown for floor wit plenti children, under tree for night.

Dem narrate say di jaguda pipo run comot from dia positions wen di Army advance towards dem, and some of di kidnappers surrender.

"Faced wit di speed, precision, and overwhelming combat power of di advancing troops, several insurgents abandon dia positions and run into surrounding mountainous terrain, while odas surrender," di military statement say.

Di authorities say di hostages dey receive medical care but two children die sake of di long captivity.

"Sadly, two infants die due to exhaustion from prolonged captivity and harsh terrain," Daniel Bwala, special adviser to President Bola Tinubu, posted on X.

Mass abductions by armed groups like dis dey common and na for ransom, sexual slavery or for negotiations.

A screengrab from a video showing a crowd of mainly and children, mostly from behind, as dem sit under a tree afta dem gain freedom from Boko Haram captivity. One of di women dey stand to di right of di image and wear a yellow headscarf.

Wia dis foto come from, @HQNigerianArmy

Wetin we call dis foto, Di rescued victims receive medical screenings and gada under trees overnight

How Nigerian Army rescue di captives

Nigeria Army say e take dem weeks of intelligence to fit face di Boko Haram and overpower dem during di operation.

Army say na inside one mountain dem rescue di captives for wia Boko Haram insurgents hold dem.

"Troops of di Joint Task Force (North East) Operation HADIN KAI (OPHK), comprising Special Forces and troops of Sector 1, don successfully rescue 360 abductees from heavily fortified Jama'atu Ahlis Sunna Lidda'awati wal-Jihad (JAS) enclave deep within di Mandara Mountains area of southern Borno State."

"Di operation, wey enta weeks of painstaking intelligence preparation, covert reconnaissance, and operational planning, result in di safe recovery of men, women, and children wey dey in captivity under harsh conditions afta dem abduct dem from several communities, particularly within di Ngoshe axis."

Di Army say di rescued captives dey undergo medical screening, as dem evacuate dem comot from di area.

"Di remaining rescued abductees dey successfully evacuated to safe locations for medical care and humanitarian support."

DI Army describe di operation major blow to di terorist group wey dey cause pleti insecurity wahala for Nigeria.

Community youths say di victims dey up to 416

Samaila Kaigama, president of di Borno South Youth Alliance (Bosaya), tell journalists say im group don dey advocate for dia release and dey in contact wit di militants.

One local group, di Borno South Youth Initiative, say dem be start di unconditional release of di kidnapped victims, putting di number of dose wey dey free at 416.

For video posted on Facebook e say some "govment boys" dey try "claim glory for our efforts".

We neva independently verify di claims of di community youths.

Map of Nigeria showing the capital Abuja roughly in the centre of the country and Borno state in the north-east. The village of Ngoshe is labelled in the south-east of Borno. A small locator show Nigeria is in the west of Africa.

Boko Haram begin military campaign to impose Islamic rule for northern Nigeria for 2009. E no longer dey control di huge territory e dey control bifor, but wit oda groups, dem remain active and dangerous.

Earlier dis year, small contingent of US soldiers deployed to Nigeria to train di West African nation armed forces and help dem wit intelligence for dia battle against growing security threats.

Meawhile, Nigerians still dey expect di safe return of shcoolchildren wey gunmen abduct for Oyo state.

For 15 May, gunmen attack three schools for Ahoro-Esinele, Ogbomoso, Oyo State, southwest Nigeria.

Di terrorists ride motorcycle to enta and attack di community and kidnap schoolchildren and teachers from Community High School, Ahoro-Esinele, and Yawota Baptist schools.

Local tori tok say dem kidnap 46 pipo, wey include seven teachers and 39 schoolchildren.