'Nigerian nationals don lose dia life, South Africa dey use xenophobia as distraction' - Wetin Nigeria and Ghana tok so far

Wia dis foto come from, EMMANUEL CROSET / AFP via Getty Images
Ghana Foreign Minister, Samuel Okudzeto Ablakwa, don accuse di South African govment say dem dey use xenophobia as distraction from di kontri problems.
Di Foreign minister Ablakwa tell di BBC say South Africa no dey do enough to stop attacks on foreigners.
"We don see videos of di South African Police as dem just dey look on, like say dem dey enjoy di scenes as dem dey attack and kill pipo, and properties dey damage," e say.
Di Ghana Foreign Minister also deny allegation by South Africa officials say Ghana dey run campaign to spoil di image of South Africa.
"Wen we first report say dem kill one Ghanaian, dem bin deny am. Wey dem issue statement wey dem give different name Kwabena Boagen, di pesin we tok say dem kill at dat time be Bashiru Isak... till today, dem no show us who di Kwabena Boagen be," im add.
Oga Ablakwa say Ghana dey investigate di reported killing of anoda Ghanaian, Kojo Antwi for South Africa. Im tok say dis incident don scata di Ghana relationship wit South Africa, wey describe di situation as "embarrassing".
For one diplomatic discussion wit South Africa envoy for Accra, President John Mahama tok say South Africa gatz protect di lives and property of African foreigners. Nigeria also don demand action from di South Africa govment.
Tension between South Africa and Nigeria dey rise ova di death of one Nigerian man, wey authorities say "collapse" wen dem bin arrest am for Cape Town.
South Africa authorities dey chook eye for dis mata, while Nigeria don demand transparent probe, citing concerns ova alleged police misconduct against foreign nationals."
Earlier dis month, di South African authorities confam di death of anoda Nigerian for June under similar circumstances.
Howeva, tok tok pesin for South Africa Department of International Relations, Chrispin Phiri, tok BBC Newsday programme on Wednesday say di govment dey take steps to deal wit dis attacks.
''We don dey investigate cases wey di state dey willing and able to prosecute any form of vigilantism or elements wia pipo don take di law for dia own hands. In fact, we get 69 cases for di western cape alone wia pipo don appear bifor di court of law wey dem dey prosecute dem.'' Im tok.
Ghana don repatriate ova one thousand nationals from South Africa.
Nigeria accuse South Africa
Nigeria accuse South Africa say dem no dey willing to protect Nigerians and oda African migrants from xenophobic attacks for di mineral-rich kontri.
For one bilateral tok for Abuja, Nigerian diplomats insist say South Africa gatz act against di wave of violence, wey im add say di relationship between di two kontris don scata.
Nigeria President Bola Tinubu bin order dat meeting afta days of looting, and attacks on immigrants for South Africa.
Di Minister of State for Foreign Affairs, Ambassador Sola Enikanolaiye, declare say Abuja bin take note of "persistent pattern of Afrophobic violence" for South Africa since 2022.
Im tok say, "at least 98 Nigerian nationals don die for mob action and hate-related violence, and extra-judicial killings
"For recent days, protesters don forces nearly 1,500 to comot di kontri afta dem destroy dia possessions and homes."
"I bin dey cry wen we receive di first group of evacuees. I see children, women, and di old pipo wey return wit nothing afta dem tiff all dia tins for dose attacks. Dis neva be di Africa we dey want", Enikanolaiye tok.
Im add say many of di pipo wey die and odas wey hurt for di immigration attacks, be legal residents.
Di minister condemn di inaction of local security agencies for several cases wey im warn against mob justice.
"As responsible African Union member state, Nigeria neva go defend bad tins by dia citizens anywia but di remedy for xenophobic violence neva be mob justice. If criminals dey among us, dem suppose face di law; dem no suppose kill dem for cold blood," di Minister explain.
South Africa deny accusations
South Africa respond to dis accusations wey dem deny say dem no dey support xenophobia, racism, or any oda form of intolerance.
Ronald Lamola, wey be President Cyril Ramaphosa Special Envoy and Minister of International Relations and Cooperation, say South Africa don arrest several pipo for attacks on foreign nationals.
E say dem go prosecute dose wey dey responsible for di violence for South Africa. Lamola tok say South Africa dey respect Nigerian sovereignty, territorial integrity, and political independence na so Nigeria gatz respect dia own borders and immigration rules.
Di toks bin end wit commitment to consult more closely on migration and security issues, as well as de-escalate rhetoric in order to maintain di longstanding relationship between di two major powers for Africa.
Meanwhile, di local pipo don blame foreigners for di high level of crime and unemployment rate for South Africa.
Reuters News agency report say at least four people don die for recent clashes, wey plenty businesses don suffer looting.
South Africa for long be destination for immigrants from Nigeria and oda kontris, despite several xenophobic violence.








