'I go extend di ceasefire' Trump tok as deadline for Iran attack near and peace tok no get head

Wia dis foto come from, DANIEL HEUER/POOL/EPA/Shutterstock
President Donald Trump say di US go extend the ceasefire wit Iran, sake of di request of Pakistan, but e go kontinue di blockade of Iranian ports.
Trump announcement to extend di ceasefire wit Iran, come as di deadline for di earlier threat set to expire on Wednesday evening.
E say di extension go give di Iran leaders more time to create "unified proposal" to end di war.
Trump post for im TruthSocial say di ceasefire go dey extended but di US military go kontinue di blockade and remain readi in case anytin sup.
E add say di extension of di ceasefire na based on di request of 'Field Marshal Asim Munir, and Prime Minister Shehbaz Sharif, of Pakistan.
"We hold our Attack on di Kontri Iran until such time as dia leaders and representatives fit come up wit unified proposal."
"I don diafor direct our Military to kontinue di Blockade and, for all oda respects, remain ready and able, and go diafor extend di Ceasefire until such time as dia proposal dey submitted, and discussions dey concluded, one way or di oda," Trump write.
Meanwhile, US Vice President JD Vance, wey dey lead di US negotiations, dey expected to fly to Islamabad for Pakistan for tok on Tuesday, but di White House say e no longer go.
Also, Iran neva decide weda to send delegation to Pakistan for tok wit di US, according to foreign ministry tok tok pesin tell di BBC.
Wen di Iran ceasefire go end?
Dem postpone di negotiations.
Trump bin warn bifor say a "whole civilisation go kpai tonight" unless Iran make deal on reopening di Strait of Hormuz. But e later announce ceasefire.
Trump decision to extend di ceasefire mark di second time for many weeks wey e go back off im threat to escalate di war.
E be like e dey buy imsef more time to wind down di conflict as e dey approach di two-month mark.
As Iran neva officially commit to attend di tok, e make am difficult for di US to decide weda to send di VP Vance since assurance no dey way di Iranian leaders go come to di table.
Meanwhile, Trump no specify dis time around how long di ceasefire fit last.
Earlier dis month, e set two-week deadline for di first ceasefire, afta e say tok dey go on but e fit resume di war if Iran refuse to negotiate.
"No clear formula dey" for ending wars, James Jeffrey, one former US ambassador to Iraq and Turkey, tell di BBC.
Trump no be di first US president to "threaten significant military escalation," Jeffrey add.
Wit di ceasefire extension, di US and Iran now get more time to make durable peace deal, but plenti kwesions still dey.

Wia dis foto come from, REUTERS/Akhtar Soomro
Strait of Hormuz dey open?
Report come say Iranian Revolutionary Guard Corps (IRGC) fire one container ship for di Strait of Hormuz, according to di UK Maritime Trade Operations Centre (UKMTO).
Di Strait of Hormuz now dey too dangerous for all as Iranian gunboats fire vessels wey dey try to get through while di US say forces don turn back more dan 20 vessels wey dey travel to or fro Iranian ports.
Iran say di US blockade of di Strait of Hormuz na act of war.
Na under di American blockade, US forces say dem go stop or turn back vessels travelling to or from Iran coast and e go kontinue until dem agree a peace deal.
Meanwhile, di UK Maritime Trade Operations Centre (UKMTO) report anoda attack on second vessel for di Strait of Hormuz.
Dem say di cargo ship don stop for water but no damage happun and di crew dey "safe and accounted for".
Report also say IRGC "gun boat" approach di vessel, but dia was "no VHF challenge", wey mean say no radio warning or hail, and den di gun boat "fire upon di vessel", causing "heavy damage to di bridge".









