You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
El-Rufai go to miss major ADC activities, go remain for detention till June
- Author, Abubakar Maccido
- Read am in 4 mins
From all indication, former Kaduna state govnor Nasir El-Rufai fit miss major activities of im party, African Democratic Congress (ADC) ahead of di 2027 general elections.
Dis na as one Kaduna State High Court don shift im case go June.
Elrufai dey face trial before Kaduna State High Court wey dey sit for Kawo, wia dem arraign am togeda wit one Amadu Sule.
Di two of dem dey face charges wey include abuse of office, fraud, intent to commit fraud, and giving undue advantage.
Di charges wey dey before di State High Court, wey ICPC also file, different from di ones wey dey Federal High Court.
Brief background of El-Rufa'i case
Afta di proceedings for di State High Court, dem later transfer El-Rufai go di Federal High Court wey still dey di same area.
But Kaduna State High Court don again shift ruling on the bail application of El-Rufai today Tuesday, April 21, 2026.
Di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC), on March 18, 2026, carry El-Rufai go court togeda wit Amadu Sule, Managing Director of TMDK Terminal Limited, before Kaduna State High Court under charge number KDH/KAD/ICPC/01/26.
Di original charges wey ICPC file range from abuse of office and fraud to intent to commit fraud and giving undue advantage, among others.
But di prosecution amend the charges on Monday and remove Sule from di case, make di trial remain only for Malam Nasir El-Rufai. For which today di court don shift am go first week of June 2026 to hear the bail application.
For anoda development, Federal High Court for Kaduna bin don grant bail to Mallam El-Rufai for 200 million naira ($148,000) and two sureties wey go bring di same amount.
Court tok say one of di sureties must dey Kaduna State and get property wey worth 200 million naira with verified CofO, while di second surety must be respected elder wey elders council certify.
Afta dem finish investigation, ICPC file 10-count charge against Mallam El-Rufai and Mr. Joel Adoga befor Honourable Justice Rilwan Aikawa of Federal High Court, Kaduna.
Di cases come from long investigation wey Commission do on im time as Govnor of Kaduna State from 2015 reach 2023, wey border on allegations of abuse of office, fraud, and money laundering.
Di charges relate to alleged conversion and possession of money wey come from corruption, plus money laundering offences wey go against di law under Money Laundering (Prevention and Prohibition) Act, 2022, and oda laws.
Di prosecution allege say di defendant collect 289,826,998.12 ($215,000) as severance allowance wey pass im correct entitlement of 20,013,245 naira between 2020 and 2023.
Dem claim say e collect $797,900 wey dem put for im domiciliary account wit Guaranty Trust Bank, from different pipo, and e sabi say di money na from illegal activities.
ICPC also allege say di defendant join bodi wit di second defendant, Mr. Joel Adoga, to hide wia $10,000 come from for July 2019.
Both defendants don deny di charges.
ICPC bin carry Mallam El-Rufai go Kaduna State High Court on amended 9-count charge on 13th April 2026.
Di charges border on abuse of office, fraud, plan to commit fraud, and giving unfair advantage, wey go against ICPC Act, Advance Fee Fraud and oda Related Offences Act, Kaduna State Penal Code, and Kaduna State Public Procurement Law.