'Atiku gatz bury di thought of running again' - Presidency reply ex-VP ontop 2027 election bid

Read am in 4 mins

Former Vice President, Atiku Abubakar don tok say di next presidential election for 2027, go be di last time wey im go contest for presidency for Nigeria, but presidency don reply am.

Atiku tok during one interview wit local media Arise News on Wednesday, say e go try di 2027 presidential election again, but e go be di last one for am.

Atiku contest di 2023 presidential election under di Peoples Democratic Party (PDP), but now, e don go join African Democratic Congress (ADC) ahead of 2027 presidential election.

Di former Vice president wey tok say if im run for di position of president again for 2027, e go be di "last show."

"Certainly, yes. Becos I believe say dat one go be my last outing. Dat one no be argument," e tok for di show.

Meanwhile, Nigeria President Bola Tinubu tok tok pesin, Bayo Onanuga don reply say make Atiku no tink of say e go contest for 2027 again.

Onanuga wey respond to Atiku interview, say Atiku go fail again if e try contest as candidate for di next presidential election.

Di president tok tok pesin argue say based on zoning, na still di South suppose be president and if Atiku try bring di North agenda to become president, e no go go well.

"Now, e stand to repeat history and face anoda doom. Anoda spectacular failure await dis perennial candidate for di next election."

'South do 18 years, North do 10 years, who be next?' - Atiku

Atiku join bodi wit oda politicians to form coalition for ADC so dem go fit defeat President Tinubu of di APC for 2027, but now, di ADC dey face some court cases.

Atiku wey dey try get presidential ticket under di ADC say im comot from di PDP to join ADC becos im no see any future for im former party.

Atiku tok say afta im lose di 2023 presidential election, e wan bin want make dem create a broader coalition wit oda politicians but di party leadership reject di idea.

"Wen di PDP lose di last election, I tell dem say I no see any future for di PDP unless dem join wit broad-based coalition."

"Di PDP leaderships no gree becos dem no wan see my face, no be becos of wetin I dey propose. Now dem don find demsef for di same situation," e tok.

Meanwhile, during di interview, Atiku tok on di issue of zoning for Nigeria.

Di anchor ask Atiku say why e still dey contest for 2027, if e still believe in zoning, sake of say di North serve for eight years as president and argument dey say make di South also do eight years bifor e rotate again.

Atiku say na error, say na only im former party PDP get zoning for dia party constitution and odas dey copy am.

"Di South don govern for 18 years, and di North don do 10 years. So, dey short if we wan dey fair?, Atiku tok.

'Atiku no go eva learn'- Presidency reply

Onanuga say Atiku dey try justify why e e dey attempt to scatta di zoning rotation arrangement.

E say Atiku dey ignore zoning formula wey don dey down even for im party, so e go fit succeed anoda northerner.

Di President tok tok pesin tok say na Atiku ambition bin lead to how PDP bin break and lose di 2023 election.

"For 2023, as member of di PDP, party wey dey practice zoning like odas, Atiku ignore di established formula and wan succeed fellow northerner, wey don spend eight years for office."

Onanuga say Atiku dey try sound like say na im be di candidate of ADC for di next election, and no go follow any rotation formula.

"Dis Atiku no go eva learn, e revisit im 2023 argument on di North-South power rotation. According to am, di South don spend more years for office dan di North since 1999. Im political arithmetic dey dubious," Onanuga say.

"E conveniently ovaooks di fact say di North shorter tenure na sake of di untimely death of President Umaru Yar'Adua, wey lead to President Jonathan succession."

Di President tok tok pesin say di situation wey happun no mean say dem go ignore di power rotation arrangement wey don dey down 'between di North and di South.'

According to Onanuga, e say as 'Buhari complete im eight years, Tinubu too gatz complete im own.'

"All Atiku need to do na to bury di thought of running again, as na still di South turn for di 2027 election."