Trump promise evri adult American $5,000 if Republicans win di midterm elections

Wetin we call dis Video, Watch: BBC North America editor Sarah Smith look into weda Trump promise stand up
    • Author, Paulin Kola
  • Published
  • Read am in 5 mins

US President Donald Trump say im go give evri adult American $5,000 (£3,700) payout if Republicans win both chambers of Congress for November midterm elections – one plan wey go cost more dan one trillion dollars.

Oga Trump make di offer for one speech for di party first-ever convention for di middle of one US presidential term.

E no give details on how e go take work or wia di money go come from – e only say dem must spend di money for US.

Vice-President JD Vance don link di plan to di revenue wey Trump raise from di US govment tariffs.

Di plan prove say e dey controversial. Democrats don label am as "empty promise" and odas don question weda dat kain promise dey legal.

Dis fit be di first time a US president go offer dat kain payout to Americans, for di context of one election year plea to get out and vote.

Di idea bin draw plenty applause for di convention and e be like say Trump enjoy di moment.

Na nearly 270 million American adults dey, wey mean $5,000 payout go cost di US govment some $1.3 trillion.

Iran war no go end until afta crucial November elections - Trump

Iran retaliation don include attacks against US bases and allies for di Gulf – but most importantly, di fight-fight lead to di closure of di Strait of Hormuz, through which about a fifth of di world oil and liquefied natural gas dey pass.

Di blockage don cause fluctuations in oil prices worldwide and Trump don face pressure from im party to end di war.

On Wednesday, US president bin warn im supporters say di war no go end until afta di midterms and e say oil prices no go come down until den.

E make di comments ahead of im speech for Texas. E argue say di short-term economic pain worth am to prevent Tehran from developing nuclear weapons.

Wetin we call dis Video, Watch: Trump says US adults will get $5,000 if Republicans win midterms

Trump long speech for di Republican convention for Dallas, Texas, touch on di core of di conflict – di impact on Americans' standard of living. Im pledge to increase dia spending power draw plenty applause for di hall.

"If di Republicans win di House of Representatives and di United States Senate, both of dem," Trump say, "I go issue a dividend to evri adult citizen for di United States of America for $5,000."

"We no wan make you go to Canada to spend di money," e tok.

"We no want make you go China, go Germany. You gatz spend di money for di United States of America." E neva dey clear how di spending go dey monitored.

BBC don ask di White House for further clarification on how Trump plan go work.

Dis no be di first time wey Trump go promise dat kain payouts – e don previously propose $2,000 cheques wey go dey funded by tariff revenues.

Vice-President JD Vance show say these post-election payments go dey possible by di money Trump don raise using im wide-ranging tariff programme.

"Wetin di president dey tok about na fundamentally a dividend for American workers," Vance tell Fox News.

"We dey take extraordinary amount of revenue bicos di president of di United States dey actually stand up to both foreign companies but also foreign countries wey dey take advantage of America workers."

Vance go on to say: "I no tink say na controversial idea."

Trump wear one blue suit and tie and white shirt, e open im arms as e dey address di convention for Dallas

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di crowd for Dallas hail Trump wey bin promise similar payments in di past

Oda US politicians for di past don also promise economic rewards in return for electoral success.

For instance, Democrats for Georgia promise $2,000 relief payments if dia party take control of di Senate for di height of di Covid-19 pandemic.

For US, Congress dey authorise spending. Di midterm elections, wey go happun on 3 November, go ultimately decide weda or not Trump Republican Party keep dia hold ova both di House and Senate.

During im speech for Dallas, di president no tok weda e plan to ask Congress for such approval for di payments – wwey e dub "Trump Dividends".

However, in addition to di overall cost to di US treasury, di latest proposal from di US president fit raise legal questions.

Federal laws ban payments wey dey intended to influence voting.

Di issue bin come ahead of di 2024 presidential election, during which billionaire Trump supporter Elon Musk offer cash incentives to registered voters in seven swing states wey sign certain petition.

However, some experts say di promise wey Trump make during Wednesday speech fit be pledge to cut taxes, wey dey legal.

John Day, one lawyer for New Mexico, tok say di plan go dey legal. E constitute a promise e make to all adult citizens of di US during one campaign, instead of "payment to individuals to try to get dem to vote in a particular way", e tell Associated Press.

Meanwhile, one election law expert wey follow New York Times tok, say Trump promise go also dey covered by di free-speech protection wey dey guaranteed under di First Amendment of di US Constitution.