Wetin to know about Joshua vs Fury fight wey many pipo don dey expect

Tyson Fury and Anthony Joshua

Wia dis foto come from, Thananuwat Srirasant/Getty Images, AFP via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Anthony Joshua and Tyson Fury don lock in to bring one of di biggest British boxing matches wey fans don dey expect for long.

Dis na as di former world heavyweight campion Fury announce am for im Instagram.

E tok say di fight go happun for Madison Square Garden for New York City even though dem neva announce any date for di fight.

According to di post fury make, "what a fight Fury vs AJ, di land of opportunity. Dis kain weekend na one wey di lads dem fit piss off NYSC. Iconic. Not long now guy".

Even though di date neva dey announced, tori be say e go hold for November afta both of dem bin sign contract wit Turki Alalshikh, wey be di Saudi Arabia General Entertainment Authority chairman.

Tyson Fury dey yab Anthony Joshua wey dey crowd afta im figgt against Arslanbek Makhmudov for April

Wia dis foto come from, Mark Robinson/Getty Images

Wetin we call dis foto, Di promise of dis fight don enta all ova di two boxers most recent competition

Howeva fans don dey enta di boxers well-well say e o make sense say dem go box all British fight for di US and not somewia like Wembly Stadium for di United KIngdom.

To add more pepper for inside di mata, even di Mayor of London, Sadiq Khan say e really wan host am for Wembley Stadium and dey ask make di promoters contact am.

E add say, "Anthony Joshua and Tyson Fury na two ogbonge British boxers. Both don be world champions. Dem both dey see and love di fans for dis kontri wey don support dem for dia careers both amateur and professional.

"Wembley don host plenti ogbonge events wey include fights wey don hry both Tyson and Anthony. We, di fans wan see dem box live ofr London".

Tyson Fury wey be 38 years old don win 36 professional matches for im time. Infact, di only two matches wey im don loose na against di same pesin, Oleksandr Usyk for 2024.

In fact im bin retire for from boxing for December 2024, afta im lose di match to Usyk wia three of di four major titles bin dey on di line. Although e later do about turn for im retirement in January.

Dis no be di first time wey dem don try to run dis link up between two of di biggest British boxers.

For 2021, tins fall apart as Joshua and Fury bin no dey able to agree on terms of di fight and di mata come even get k-leg afta US judge bin rule say Fury go need to face Deontay WIlder for trilogy fight instead.

But di two dem don dey plan for dis match even wit di oda fights wey e dey enta.

For July dis year, Fury make one Polish fighter Mauriusz Wach to retire afta e beat am for di Max Muay Thai Stadium for Pattaya, Thailand.

For dat same July, Joshua bin fight im first fight since im bin dey di car accident for Nigeria wey claim two of im close friends lives.

E bin fight wit Albanian Kristian Prenga for 25 July and bin win against am for di second round of di fight. Dis na even afta di former kickboxer bin knock Joshua down two times in di first 20 seconds.

How many times Joshua vs Fury fight almost happun

Anthony Joshua and Tyson Fury for different times dey hold all di championship belts wey dem don hold

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For 2020, di two British boxers bin dey hold all four of di major championship belts for professional boxing

Apart from di 2021 fight wey tin no gree work out in terms of di deal wey di two Briton boxers bin come to, e get anoda time wey dem two agree to fight, not one but two fights.

Yesso, for June 2020, boxing promoter Eddie Hearn, one of di pipo wey announce dis latest fight wer dey set to happun for November, bin reveal say, yes di two of dem bin gree fortwo time deal.

But dem bin no even get venues or dates planned at di time.

Apart from dat, di two boxers bin de on di hook to do oda fights bifor dem go fit meet.

Joshua wey bin win im World titles back for December bin need to face Bulgaria Kubrat Puley when di sport resume fully afta di ban dem put sake of coronavirus.

Fury bin also need fight Deontay Wilder again, as im bin collect di WBC title from am for February dat year..