Nigerian political parties wey don announce dia presidential candidates for 2027 election

Wia dis foto come from, Collage
- Author, Adesola Abisoye
- Role, BBC News Pidgin
- Published
- Read am in 6 mins
Di Nigeria presidential election dey expected to hold January 2027, all tins equal and political parties don dey announce dia flagbearer.
Accross di kontri, major political parties do dia primaries to elect who dia candidate go be, while some also adopt concensus.
Wit Independent National Electoral Commission (Inec) gearing up to receive names and details of evri eligible candidates from dia party for di 2027 election, di stage don set.
Political parties get small time to submit di candidate details, so as to meet up wit Inec deadline.
From di ruling All Progressives Congress (APC), to Labour Party, Young Progressives Party (YPP), Africa Democratic Congress and to di new Nigeria Democratic Congress (NDC) - candidate announcement dey circulate.
BBC News Pidgin chook eye to loook some of di candidates wey dia party don alreadi announce and dose wey win as flagbearer to represent dia party for ballot during di 2027 presidential election.
All Progressives Congress (APC) - Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Nentawe G. Yilwatda / X
Bola Tinubu na di incumbent president of Nigeria under di All Progressives Congress (APC) afta dem declare am winner of di last 2023 presidential election.
Again for 2027 election, APC don anounce Tinubu as di winner of di presidential primaries wey make am di party flagbearer.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Tinubu emerge victorious wit total of 10,999,162 votes, while im opponent Stanley Osifo secure 16,503 votes.
Asiwaju Bola Tinubu na former Lagos state govnor, South west Nigeria.
Di two term govnor of Lagos bin also serve as senator during di brief third republic for Nigeria.
Dis go be im second time to contest di presidential election.
Na im party dey currently in office so dat one make dem di party to beat.
Im vice presidential candidate for 2023 na former Borno statet govnor, Kashim Shettima - e possible say e go maintain am like dat or change running mate.
Africa Democratic Congress (ADC) - Atiku Abubakar

Wia dis foto come from, Atiku Abubakar/X
Atiku Abubakar na di flagbearer of Africa Democratic Congress (ADC) for di 2027 presidential election.
During di primary, Atiku get a total of 1,846,370 votes, to defeat im rivals, former Rivers State govnor Rotimi Amaechi (504,117) and businessman Mohammed Hayatudeen (177,120).
Atiku na man wey don tey for politics. Im don attempt to be president several times for different political parties.
Im be former Vice President of Nigeria and PDP Presidential Candidate for 2023 election wia e come second.
2027 go be about di seventh time wey Atiku go seek to become Nigeria president afta e first show interest for 1993 even though e no get im party ticket at di time.
Di Adamawa state born businessman contest general elections for 2007, 2011, 2019 and 2023 elections.
We dey expect who Atiku go announce as im running mate.
Nigeria Democratic Congress (NDC) - Peter Obi

Wia dis foto come from, Peter Obi/X
Nigeria Democratic Congress (NDC) confam Peter Obi as dia presidential candidate.
Peter Obi na former govnor of Anambra state for southeastern Nigeria wia im get strong record. E also get active support base for social media.
Im be former candidate of di Labour Party for di 2023 election wit im vice Yusuf Baba-Ahmed, a former Senator from Kaduna state.
Dis go be di third time wey di former two term govnor go dey ontop presidential ticket as e serve as running mate to Atiku Abubakar of di PDP for 2019 elections, and presidential candidate for 2023, and now in anoda party as flagbearer.
Obi first comot Labour Party to join ADC, bifor e later come go NDC.
Obi announce former Kano govnor Rabiu Kwankwaso as im running mate, during di party special convention.
Young Progressives Party (YPP) - Anita Zugwai-Chukwu

Wia dis foto come from, Screenshot/YPP
Di Young Progressives Party (YPP) announce a female as dia presidential candidate for di 2027 election.
Mrs Anita Zugwai-Chukwu, na di party sole presidential candidate for di 2027 general election during dia third national convention wey hold for Abuja.
E be dia National Women Leader, and also hold some oda positions.
Zugwai-Chukwu emerge unopposed for di convention wia party leaders and member cast dia vote to make her di presidential flagbearer for di party ahead of di next general election.
Allied Peoples Movement (APM) - Seyi Makinde

Wia dis foto come from, Seyi Makinde/X
Oyo state govnor, Seyi Makinde become di presidential candidate for Allied Peoples Movement (APM) for 2027 election.
Dem announce am during di Presidential Primary Election and Unveiling Ceremony wia party memebrs and stakeholders endorse am as di party presidential candidate for di 2027 general election.
E become elected Governor of Oyo State on March 10, 2019, and later re-elected for anoda four years.
Bifor e enta politics, e be engineer and businessman wia e serve as Group Managing Director of Makon Group Nigeria Limited, wey e create.
Makinde say im vision as President of Nigeria, na to work to reform national security architecture so dat States no longer dey helpless for moments of crisis.
E neva announce any running mate.
Labour Party (LP) - Kennedy Ahanotu

Wia dis foto come from, Labour Party/X
Di Labour Party don adopt Prince Kennedy Ahanotu as di party presidential candidate for di 2027 presidential election.
Ahanotu na di National Youth Leader of di party but e don become di presidential flagbearer.
Prince Kennedy pull total vote of 2,944,420 through consensus primary election.
"I proudly accept di nomination of our great party, di Labour Party, as dia Presidential Candidate for di 2027 General Election," e tok for im acceptance speech.
Peoples Democratic Party (PDP)
For Peoples Democratic Party (PDP), some internal crisis still dey go on as di party still dey divided into two factions, and di two groups don nominate presidential candidate each.
On Tuesday, 26 May 2027, di PDP faction wey di current Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, dey support, nominate one former Senator, Sandy Onor, as dia consensus presidential candidate.
For di event for di PDP national secretariat for Abuja, chairman of dia screening committee, Samuel Ortom, tok say Onor na di outstanding candidate wey dem sure say e go take di party to victory.
Anoda faction say dem wan affirm former president Goodluck Jonathan as dia candidate.













