UK Prime Minister Andy Burnham cancel engagements afta im papa kpai

Andy Burnham hugs his parents, Eileen and Roy, after he was selected as the Labour candidate to become the mayor of Greater Manchester in September 2026. They are standing in front of a red banner reading "Labour North West".

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Burnham pictured with his parents, Eileen and Roy, after he was selected as Labour's candidate to become the mayor of Greater Manchester in 2016
Published
Read am in 3 mins

UK Prime Minister Andy Burnham don cancel im engagements for Monday and Tuesday afta di death of im papa Roy.

Burnham don previously speak about im papa, wey bin get Alzheimer's, wen im bin dey explain why e bin dey determined to reform adult social care for England.

Di PM suppose host one meeting of business leaders for Downing Street later.

E reveal say im papa no know say e don become prime minister for July, becos of im condition.

Bifor e enta No 10, e bin tell di Times Newspaper say na "sadness, bicos e for dey [proud]".

"Di way I look am, na im achievement as well. A whole family achievement, although e no know am."

E later say care home staff bin show im papa footage as im dey enta Downing Street, and e call am "wonderful" tin.

Burnham bin refer to im papa experience wen e bin pledge adult social care reforms for July, wen im bin say im bin wan help "my dad and di millions like am".

Im tok say im bin dey "overwhelmed" by di skills and professionalism of care workers wey dey support im papa.

Burnham don describe how im papa, wey be former telephone engineer, bin raise am wit "laughter, love and support" alongside im mama Eileen for Culcheth, Cheshire.

For im 2024 book Look North, im bin write say none of im parents bin attend university, but dem for attend if to say dem bin "grow up for different time and different place".

"Dia knowledge of di fact be like say e make dem more determined say dia three sons go attend."

Opposition politicians don send dia condolences to Burnham and im family.

"No mata how old you be, or how much you try to prepare, to lose your papa na veri painful experience," Conservative leader Kemi Badenoch write on social media.

"One part of your life wey dey always dey dia go just suddenly go forever and e go feel like say one part of you no go eva be di same again."

Liberal Democrat leader Sir Ed Davey say: "My heart go out to di prime minister on di loss of im dad.

"From our conversations e sound like a wonderful man."

Green party leader Zack Polanski say: "E get moments in life like dis sad time wey dey transcend politics and I join di whole kontri to send condolences."